Mazi: This period wey we dey like this, person suppose dey very very very careful o Egbon: Before nko, with the many…
Browsing: pidgin news
Egbon: If i talk now, Mazi, you go say i too dey complain o, you go say, i no dey hopeful,…
Egbon: Sanwo-Olu bin dey think say him fit carry us join body, him dey try make us forget the thing wey…
Mazi: This news wey i hear dey do my body one kain o, how Government go destroy people Business like this,…
Egbon: Hmm, sometimes, this Buhari government go dey make me wonder whether naa Democracy we still dey practice for this…
Mazi: Hmm, If i combine the Grammar wey i don hear for this 2020 alone, i fit do my own dictionary…
Egbon: (Clap….), nawa o, small small, this thing don dey turn normal something among our Politicians, e be like say naa…
Mazi:This matter don dey give me concern like this o, the bad thing wey this EndSARS protests cause don dey…
Mazi: Naa the reason why i dey always talk say e no too good to dey believe everything wey dey ontop…
Abeg. You know. You know say all these people dey do things for their own selfish reasons but you just no wan gree with me. Anyway, you know say me I tell you say strike or no strike I go open my shop; I glad say I no buy into all these their nonsense
Yes, because from the thing wey I don see; first of all ASUU strike no dey solve any wahala at all. The strike go just waste the time of people children and the amount of time wey dem suppose spend for school go increase with no merit.
Ahn Ahn, you never hear say labour congress go start strike starting from 28th of September?
This thing wey you talk now na the same thing wey Atiku Abubakar talk now now now now. En talk say god fatherism don dey end. E even talk say make Iyamu work with obaseki and make en let go of the leprosy wey e hold for hand.
I no care… whether dem test or dem no test, we get ninety cases. If to say the cases dey increase; you for don hear how some people dey die…. With or without test. You know how many cases dey India right now?
Egbon, you don hear say dem don increase fuel price? Mazi my brother, I don hear. I talk am… the…
I be inspector general of police? Na the wan wey I read or hear na em I dey tell you. No be every trial you go hear about now… you know how many rape case wey dey court as we dey talk right now? E plenty now
Nna enh, na this morning my pikin tell me say she apply but dem no pick am and I come tell am say make she find another thing to do say big brother no be good place to go o, na em she come nack me with this eighty five million naira news.
If not medical treatment den wetin go carry am go? How her journey to Dubai take concine her pikin marriage
Na the exact thing wey Femi Fani Kayode talk be that but even though na stupid question, e no warrant for Femi Fani Kayode to insult am like that and now because of the insult wey e rain for the journalist head e don enter wahala
No be the first time wey you dey patronize me but na the first time wey you dey bring list be this; which mean say you dey come buy my entire shop.
I hear something o, dem invite El rufai to go talk for their Nigerian bar association meeting and dem come tell am say make e no come again… no be that wan?