My own be say pondei still dey talk of something wey don happen and we don forget, instead of him to transfer money to the international students dey abroad on the NDDC scholarship.
Browsing: pidgin news
Abeg explain further because this thing wey you talk now enh, I no understand; Kano singer sing song… dem talk say e blaspheme and sentence am to death. Abeg which kind blaspheme person go blaspheme wey go deserve death sentence?
Na wa o. why everybody just dey get transformer issues, you hear of the some people for lagos wey go pray for their transformer?
No be say dem no go share the vaccine but e get somethings wey dem go first do before the thing go spread go other countries. Now wey dem don do the corona virus vaccine for Russia, other countries go buy the sample and test am first… na after that test then dem go start to dey buy am in bulk to share to their people.
That one too dey. And if kashamu buruji family no reply am, another politician go reply am just wait and see.
Na your own dey worry you this morning. Anyway, dem don fly Aisha Buhari go dubai for treatment… she dey sick
Na today insecurity start for Nigeria? Wetin even bring insecurity talk from your mouth this morning
Commot come where? Wey school still dey in session? Wetin she go come this country come do… e be like say you no hear say she be student
Which kind yeye talk be that? So if other regions dey still money, e mean say the money wey dem steal for NDDC dey justified… e be like say Asari Dokubo dey among dey people wey chop from the money
Nna enh, na now e get the memo to move. So now wey everybody don commot from PDP go APC because na them be the winning party; by the time PDP win election again and dem put person for presidential seat, dem go deflect again?
Abeg, help me explain the thing wey that man dey do? Na mouth to mouth e wan do for NDDC MD or na wetin? Abi dem don dey do mouth to mouth with mask for face?
Nne enh, common to watch network news yester night na big problem between me and my wife, she talk say na big brother she wan watch and as I no want quarrel now… I come give am remote
No be like that Mazi, the hand sanitizer wey I dey keep for parlour, that big type; na your shop I send my pikin to go buy am and because she no dey hear word, she come go her own friend shop go buy the hand sanitizer and now wey I dey smell am enh…. E be like say e dey smell like pomade
Mr Ibu talk say corona virus no exist for naija, because e no know anybody wey get the disease or wey the disease don kill
See dey person wey dey talk say abacha dey smell. Abacha no smell pass dey amala and gbegiri wey you dey chop almost every day.
Na day before yesterday dem announce am o, say dem don succeed for lap and dem now know how to dey make corona test kit
My brother, exercise is good for the body and I decided say today I go go do some exercise. How far now, wetin dey happen with third mainland bridge because I know say something don happen as you call am
I no go come myself, na government I go send make dem come evacuate you dey way wey dem dey evacuate people from different country; you go tell me the thing wey dey that east wey you no fit siddon for Abuja
E no be any spiritual problem jare. You fit talk say the flood wey dey for Benin be spiritual problem but not the flood in lagos state
I happy say you call oyinbo land, you no call naija… na oyinbo land we dey? And even for that oyinbo wey corona dey kill dem anyhow, dem no get interstate travel ban
I even surprise say dem do the burial on time, I think say all these delay wey Abiola Ajimobi family dey announce go turn to family quarrel; you know as death of a family leader fit scatter the family way.