Na lie jare, which kind yeye thirty one billion naira. Thirty one billion naira and them still no get isolation centre for all the thirty six states wey dey this country.
Browsing: Egbon and Mazi
Pidgin News, Egbon jimoh and Mazi okoroafor weekly episodes fun breakdown of News and happens around Nigeria.
With the world health crisis going on, reading the news can get inundating or even sad; that is why at everyevery.ng we have come up with a way for you to read the news without the intensity that comes with it. We’ve called it Pidgin News.
Our Pidgin news is not the typical reporting of the news in pidgin English; it’s two middle aged Nigerian men discussing the news with the little knowledge they have of the world. It promises humour and also knowledge of everything you need to know about what is going on in the country.
Egbon, you don hear say dem don increase fuel price? Mazi my brother, I don hear. I talk am… the…
I be inspector general of police? Na the wan wey I read or hear na em I dey tell you. No be every trial you go hear about now… you know how many rape case wey dey court as we dey talk right now? E plenty now
Nna enh, na this morning my pikin tell me say she apply but dem no pick am and I come tell am say make she find another thing to do say big brother no be good place to go o, na em she come nack me with this eighty five million naira news.
If not medical treatment den wetin go carry am go? How her journey to Dubai take concine her pikin marriage
Na the exact thing wey Femi Fani Kayode talk be that but even though na stupid question, e no warrant for Femi Fani Kayode to insult am like that and now because of the insult wey e rain for the journalist head e don enter wahala
No be the first time wey you dey patronize me but na the first time wey you dey bring list be this; which mean say you dey come buy my entire shop.
I hear something o, dem invite El rufai to go talk for their Nigerian bar association meeting and dem come tell am say make e no come again… no be that wan?
My own be say pondei still dey talk of something wey don happen and we don forget, instead of him to transfer money to the international students dey abroad on the NDDC scholarship.
Abeg explain further because this thing wey you talk now enh, I no understand; Kano singer sing song… dem talk say e blaspheme and sentence am to death. Abeg which kind blaspheme person go blaspheme wey go deserve death sentence?
Na wa o. why everybody just dey get transformer issues, you hear of the some people for lagos wey go pray for their transformer?
No be say dem no go share the vaccine but e get somethings wey dem go first do before the thing go spread go other countries. Now wey dem don do the corona virus vaccine for Russia, other countries go buy the sample and test am first… na after that test then dem go start to dey buy am in bulk to share to their people.
That one too dey. And if kashamu buruji family no reply am, another politician go reply am just wait and see.
Na your own dey worry you this morning. Anyway, dem don fly Aisha Buhari go dubai for treatment… she dey sick
Baby making factory na baby making factory. You see some of these midwives wey dey for east especially… dem go kidnap small small girls and get man to give all of them belle and wen dem born, dem go come sell the pikin
Egbon, hydroxychloroquine no be cure for corona… some doctors don talk say e dey work for their patients and other doctors talk say e no dey work for their patients.
Na today insecurity start for Nigeria? Wetin even bring insecurity talk from your mouth this morning
Commot come where? Wey school still dey in session? Wetin she go come this country come do… e be like say you no hear say she be student
Which kind yeye talk be that? So if other regions dey still money, e mean say the money wey dem steal for NDDC dey justified… e be like say Asari Dokubo dey among dey people wey chop from the money
Nna enh, na now e get the memo to move. So now wey everybody don commot from PDP go APC because na them be the winning party; by the time PDP win election again and dem put person for presidential seat, dem go deflect again?
Abeg, help me explain the thing wey that man dey do? Na mouth to mouth e wan do for NDDC MD or na wetin? Abi dem don dey do mouth to mouth with mask for face?