Browsing: Podcast

Abeg. You know. You know say all these people dey do things for their own selfish reasons but you just no wan gree with me. Anyway, you know say me I tell you say strike or no strike I go open my shop; I glad say I no buy into all these their nonsense

Yes, because from the thing wey I don see; first of all ASUU strike no dey solve any wahala at all. The strike go just waste the time of people children and the amount of time wey dem suppose spend for school go increase with no merit.

This thing wey you talk now na the same thing wey Atiku Abubakar talk now now now now. En talk say god fatherism don dey end. E even talk say make Iyamu work with obaseki and make en let go of the leprosy wey e hold for hand.

I no care… whether dem test or dem no test, we get ninety cases. If to say the cases dey increase; you for don hear how some people dey die…. With or without test. You know how many cases dey India right now?