Browsing: Podcast

So how that judgment take concine you? Yes, I agree with the thing wey dem dey do for kaduna; anybody wey wan go rape person pikin, make dem castrate am. Since e no wan get self-control… government go give am self control

Na wa o. your patience don loss this morning. The good part be say fuel price fit reduce to the barest minimum; if something happen now and fuel dey everywhere, the price of fuel fit reduce well well and you fit even buy fuel for twenty naira per litre

I be inspector general of police? Na the wan wey I read or hear na em I dey tell you. No be every trial you go hear about now… you know how many rape case wey dey court as we dey talk right now? E plenty now

Nna enh, na this morning my pikin tell me say she apply but dem no pick am and I come tell am say make she find another thing to do say big brother no be good place to go o, na em she come nack me with this eighty five million naira news.

Na the exact thing wey Femi Fani Kayode talk be that but even though na stupid question, e no warrant for Femi Fani Kayode to insult am like that and now because of the insult wey e rain for the journalist head e don enter wahala

Abeg explain further because this thing wey you talk now enh, I no understand; Kano singer sing song… dem talk say e blaspheme and sentence am to death. Abeg which kind blaspheme person go blaspheme wey go deserve death sentence?

No be say dem no go share the vaccine but e get somethings wey dem go first do before the thing go spread go other countries. Now wey dem don do the corona virus vaccine for Russia, other countries go buy the sample and test am first… na after that test then dem go start to dey buy am in bulk to share to their people.