Browsing: news

Make I help you understand. You see enh, NCDC announce today say the new cases wey commot reach one hundred and ninety five; you know wetin e mean? E mean say cases don dey fire up and if cases dey fire up like this, commoting of lockdown no be good news at all at all and for you to go open shop and risk your health that wan too no be good news.

I don talk my own. You how I no like fake news because fake news dey cause serious problem for this world; some people don die because of fake news. No talk say I dey spread fake news, instead just talk say dey wan wey I hear no correct

I dey tell you. Na em make kwara state government to announce officially say amala no dey cure corona virus. The thing just dey burst my head since morning. Imagine say amala dey cure corona virus; the kind thing wey for happen for this country ehn

My brother, na so life be. We go siddon make plan but nobody know how life go go. The only thing be say we go thank God say we even get life to see Easter this year and as we see the Easter, na so we go see every other celebration for this year.

You know say government talk say for this lockdown, dem go give people money and I see am for NTA news yesterday say dem don start to the transfer money to people. Dem send to you? Or you know anybody wey dem don send to?

My brother, no be because of my sister pikin. As en mama drop am here and school no dey, I come hear say star times get better program for children wey go dey teach them dey things wey dem suppose learn for school