Hello Mazi, you read the thing wey Femi Adesina write?
Egbon, I see am o… en dey compare this country with China. So if China president no wan address en people for this kind period; e mean say Bubu no go also address en own people? Wetin be the sense for that kind talk?
Nna enh, if you ask me, who I go ask? Since this corona wahala begin; na only once Bubu don address us and with the way the case don dey expand every day, e no good at all
At all at all. Our president suppose address us about everything wey dey happen; even if no be everyday en go address us, at least once in a while good
Some people believe say the president of the country no need to dey address en people but dem no know say sometimes na the thing wey president talk na em people go hear pass the thing wey governor talk
My brother abeg help me tell them. Just leave people like Femi Adesina wey no know anything. Maybe the president don give am wan small money.
Mazi, you see for news say most people for Abuja no dey follow the lockdown orders?
I see am o But wetin dey worry some people for this country; government talk say make you siddon for house, for your own good oo but people no wan hear
Honestly, sometimes Nigerians dey tire me. Every day we dey complain say government no good, government this and that but sometimes na we we be the problem for this country
I dey tell you. I even see for news say wan market dey open as if nothing dey happen for the world; people just dey waka as if lockdown no dey
If Bubu, commot and address us as president warn people again about this lockdown; at least many people go know say this lockdown no be joke
For say I no get sense, mesef for go market open my shop but life better pass money. Na person wey dey alive fit spend money
You don talk am finish. Atiku pikin even do interview from the place wey dem quarantine to beg Nigerians to follow government orders.
En still dey sick? I think say dem don treat am release am finish
Aaah. En still dey quarantine o. you think say this virus na catarrh and cough wey dey clear within a few days? Na life and death sickness be this o
I know say e no be like catarrh but ahn ahn e never reach one month since he catch the disease?
One month? No, I no think say e don reach one month; maybe two weeks or so
Ehenh, at least thank god say en don well enough to even do interview sef.
Abi, no be because dem catch en own on time and en treatment start quick; other people no go too lucky
Honestly, that na why we suppose take this lockdown seriously.
Abeg, make I come dey go before you finish my credit
Ok o no problem, you do well say you call me today
Bye bye.
Stay safe oo