Hello… Egbon… Hello… see me see trouble o. This man pick phone dey talk to another person.
Hello Mazi, how far now?
How you go pick my call dey talk to another person? You think say credit dey grow for my backyard? No be 5G network be this o
Abeg no vex, na my pikin just dey annoy me. How big man like you go dey complain about credit and you never hear say MTN dey do bonanza?
So because MTN dey do bonanza, make I finish everything at once?
Tor sorry, abeg no vex. Wetin be all these 5G network wey I dey hear of everywhere?
Nna enh, the only thing wey I know na say the thing better pass 4G but to use am, you go first put something for your body
Enh!! Put something inside my body? As how?
I no know o. dem talk say the thing be like memory card; dem go put am inside your body so that your network no go ever spoil. But some people come talk say na the 5G network cause the corona virus spread for china.
So because of network I go come cut my body carry memory card put inside. Olorun maje; wetin the world dey turn into?
My brother, the 5G thing done dey cause wahala everywhere, every one pastor like that… wetin be in name sef? Chris oyahilome come talk say na anti-Christ thing the 5G be; say anybody wey use am don give en soul to devil
E be like say I here am sef. All these pastors with their conclusions
Another pastor even join mouth, pastor Enenche; en talk say anti-Christ no fit come this world while the church still dey this world say for anti-Christ to come, rapture must to happen first.
Na true be that now. No be so bible talk? say rapture go first happen, then after rapture then anti-Christ go come do en own
But Minister of Communication don talk say no research wey link the 5G network to the spread of corona virus. En even talk say 5G network no dey Nigeria.
How e go dey Nigeria? No be last we dey carry for things like this?
Nna enh, before something reach this country e for don reach every other country for this world
You know am. Ehen, na true say dem arrest that actress… Funke Akindele?
Yes o. NCDC carry am yesterday; you think say the thing wey she and her husband do na small thing?
I know say no be small thing but
But wetin?
But nothing. If for say dem no arrest am, e go mean say all these wahala wey we dey do to go on lockdown and stop this disease na for nothing
Gbam! And aside that one sef. What if one person come that her party come give everybody for that party corona virus? Wetin dem go talk?
My brother, this thing wey you talk now na serious thing, very serious thing.
Hmmm, I know just understand some people and na this same Funke Akindele do advert to tell people say make dem follow due process to prevent the sickness
Na wa o and na she come throw big party for her house, I even hear say dem wan arrest the naira marley wey attend the party
Na everybody wey go that party dem wan arrest even former lagos governorship aspirant sef
Aah, big big people go this party o
Yes now. I pray dem go use this Funke Akindele woman for example.
Dem go do am, if dem no do am another person go throw en own party.
Exactly. Make I go chop
Okay o. bye bye.