Browsing: news

Abeg explain further because this thing wey you talk now enh, I no understand; Kano singer sing song… dem talk say e blaspheme and sentence am to death. Abeg which kind blaspheme person go blaspheme wey go deserve death sentence?

No be say dem no go share the vaccine but e get somethings wey dem go first do before the thing go spread go other countries. Now wey dem don do the corona virus vaccine for Russia, other countries go buy the sample and test am first… na after that test then dem go start to dey buy am in bulk to share to their people.

Nna enh, na now e get the memo to move. So now wey everybody don commot from PDP go APC because na them be the winning party; by the time PDP win election again and dem put person for presidential seat, dem go deflect again?