Egbon, good morning o… I don come back o. I say make I call you tell you
Aaah Mazi, that’s good , welcome back. I think say you no wan come back again now. So wetin you bring for me from east now?
I bring correct abacha? You dey chop abacha?
That thing wey dey smell anyhow. No o I no dey chop am
See dey person wey dey talk say abacha dey smell. Abacha no smell pass dey amala and gbegiri wey you dey chop almost every day.
Haba Mazi, how you go compare abacha with amala and gbegiri; you sef check am now, na black amala black… e no dey smell at all at all
Which kind lie be that? Abi you no know say I don chop amala before?
And me sef, I don chop abacha before and if you ask everybody for this town dem go tell you say abacha dey smell pass amala… in fact amala no dey smell at all.
Anyway, make we leave this yeye argument. I see say another house don collapse for lagos and three people don die
Na wa o. this lagos building collapse wahala don turn to nbkj0 another thing o; e no get any month wey we no go hear say wan house or building collapse for lagos and government no dey do anything about am
My brother, for this kind thing enh, dem suppose carry the engineer wey build the place go jail.
Even if dem no go jail, dem suppose punish somebody and make dem to pay money; so that other people go learn how to build well. You know how many buildings don collapse for lagos alone this year?
The number don pass ten o
Wetin be ten? Abi e don even reach and pass twenty, see this wan wey just happen wey kill three people; e never happen finish o… another building don go collapse again for that same lagos and my problem be say dem no go learn.
Na dem dey experience flood and now dem don add this collapsing of building… ahn ahn e never tire dem.
Tor, maybe dem dey wait until another building collapse and kill hundred people before lagos government go take action.
You don hear the update for Magu tori?
Hmmm, my brother, the thing wey I hear enh shock me…. Dem talk say dey money wey en steal go reach four hundred and fifty million dollars
Enh! Four hundred and fifty million dollars!!!? No be the same amount wey hushpuppy steal be that?
Na true o. if you check am the amount dey almost the same; you hear say en even give Osinbajo eight hundred million naira wey en give en pikin to buy house for wuse 2?
Na wa o. I no hear that wan o. wetin Osinbajo come talk?
Wetin e go talk? e deny am now. Talk say e no get any involvement, say the house wey en pikin dey use for office na rent she dey rent am… no be buy she buy
You believe en tori?
Bird dey shit for toilet?
Exactly, because mesef I no believe that tori. On a normal day sef… politicians no dey buy property for their name so that people no go know
Na this same thing wey you talk now I tell my wife, so the house fit be for another person name, meanwhile na dem get am. Dem even talk say Magu use pastors to transfer money go oyinbo land
Ahn ahn … so we dey fight against corruption while Magu dey fight against poverty.
My brother na so we see am.
Make I come dey go work, go do my own fight against poverty.
Wen dey money enter, no forget us oo.