Browsing: Podcast

Nna enh, I hear the news this morning o, so sad. And you know the funny thing me and my wife been dey hear em music last night o. majek fashek, what a great musician

Na wa for you o. small talk wey I talk with low voice e don enter be careful, make I wear mask and you tell you say I suppose wear mask while I dey talk to person for phone? Even if I get cough I no suppose wear mask to talk to you for phone

No be the scamdemic wey you talk now now be the corona cake? Instead of dem to use the money to buy or make more test kits and test more people; dem don start to dey share the money.

Make I help you understand. You see enh, NCDC announce today say the new cases wey commot reach one hundred and ninety five; you know wetin e mean? E mean say cases don dey fire up and if cases dey fire up like this, commoting of lockdown no be good news at all at all and for you to go open shop and risk your health that wan too no be good news.

I don talk my own. You how I no like fake news because fake news dey cause serious problem for this world; some people don die because of fake news. No talk say I dey spread fake news, instead just talk say dey wan wey I hear no correct

I dey tell you. Na em make kwara state government to announce officially say amala no dey cure corona virus. The thing just dey burst my head since morning. Imagine say amala dey cure corona virus; the kind thing wey for happen for this country ehn