I no talk say you no work now, na wetin I talk be that? I just dey tell you say I no dey follow other people resume office but I go dey work from my house.
Browsing: pidgin news
Ehn? Two hundred and what? I no understand, shey dem talk say with the measures on ground dem go reduce the new cases of corona?
Make I help you understand. You see enh, NCDC announce today say the new cases wey commot reach one hundred and ninety five; you know wetin e mean? E mean say cases don dey fire up and if cases dey fire up like this, commoting of lockdown no be good news at all at all and for you to go open shop and risk your health that wan too no be good news.
E no surprise me now; when all these oyinbo countries never commot their lockdown, na Ghana wan form nonsense. Mtshw
I don talk my own. You how I no like fake news because fake news dey cause serious problem for this world; some people don die because of fake news. No talk say I dey spread fake news, instead just talk say dey wan wey I hear no correct
No be say dem wan use BVN give people money but na your BVN dem go use know whether you get money or you no get money
Dem dey play too much; everything dey easily turn to play for their eyes. Ehen, you see for news say Abba Kyari no even contact NCDC wen en catch corona?
I dey tell you. And you know say trip wey carry Kyari go Germany that time, no be him suppose go; na Osibanjo suppose go that Germany trip
I dey tell you. Na em make kwara state government to announce officially say amala no dey cure corona virus. The thing just dey burst my head since morning. Imagine say amala dey cure corona virus; the kind thing wey for happen for this country ehn
Na the same thing wey I tell my wife be this. I tell am say we go do our own good Friday mass for house and god go hear am. E no mean.
Na so we see am o. This period wey people dey find money and people need money to buy things for lockdown, na em pastors still dey talk about tithe and offering for internet.
I no know o. dem talk say the thing be like memory card; dem go put am inside your body so that your network no go ever spoil. But some people come talk say na the 5G network cause the corona virus spread for china.
At all at all. Our president suppose address us about everything wey dey happen; even if no be everyday en go address us, at least once in a while good
You know say government talk say for this lockdown, dem go give people money and I see am for NTA news yesterday say dem don start to the transfer money to people. Dem send to you? Or you know anybody wey dem don send to?
Mazi, no dey ask question wey no get answer. You dey talk as if you no know the country wey you dey. Even as dem don declare lock down today today, some people go still sleep for road.
My brother, no be because of my sister pikin. As en mama drop am here and school no dey, I come hear say star times get better program for children wey go dey teach them dey things wey dem suppose learn for school
No. Bubu never get am; dem test am and the test come out negative but Osinbajo don isolate enself because en don hug and shake Kyari.
I swear. No body for my house hold dey commot without face mask and gloves. I know say people dey look us but e better like that. Prevention is better than cure
I hear am but the thing be say dem never verify am o. no go dey drink Chloroquine for no reason; na trial dem still dey do
Aaah, Mazi you no know say as doctors dem get high risk to catch the sickness or disease wey dem dey treat and the hazard money government allocate to them in case dem catch disease from treating person na five thousand naira
Mazi, I wan understand something. This oil wey we get for this country, na blessing abi na curse? Because every day na so so fire fire and if e no be oil tanker cause am den na oil pipeline. E don too much now