Egbon, na only bad news dey this country? E be like say news don dey tire me o because na so so bad news person dey read everytime
Mazi, wetin happen this time?
You never hear say doctors for Nigeria wan go on indefinite strike? Meaning dem no go work again and dem no know the time wey dem go resume work; for this period? with everything wey dey on ground? Na em dem wan go on strike, no be selfishness be that?
I hear am o. you know enh, even me sef I be dey think the same thing when I hear the news; say dem be selfish people but as I come hear their own side of the story, the thing make me understand with them small
Abeg, wetin be their own side of the story?
Aaah, Mazi you no know say as doctors dem get high risk to catch the sickness or disease wey dem dey treat and the hazard money government allocate to them in case dem catch disease from treating person na five thousand naira
Wetin be hazard money
For example if doctor dey treat you for HIV
Abeg, no be me na another person
Okay, if doctor dey treat another person for HIV and the needle chuke the doctor and en come also catch the HIV. The money wey government go give am for treatment na five thousand naira.
Enh? Ewoo! Only five thousand naira?
Yes, na only five thousand naira and you know say the sickness wey dey on ground now no be small something. Na doctors and health practitioners e dey kill the most
Hmmmm, na wa o. enh mesef I understand but why now? Why doctors no go on strike in the time of ebola; and you know say ebola time even take style bad pass this one
Mazi, I no know. Na them know wetin dey worry them. But the truth be say strike no be the answer; they are other ways to do things and come to an agreement with government
Exactly, strike no be the answer. All these strike wey government workers and doctors dey do; na because dem know say dem no go sack dem
How dem go sack dem, when the constitution allows for freedom of expression and the right to be compensated for your work
Egbon, leave that English wey you dey speak. You know how many doctors dey graduate from school every year? If government sack everybody wey dey on strike come replace dem with incoming doctors, nothing go happen
That one fit crash the health industry o. na farmers you fit replace like that no be doctors. Sanwo Olu talk say en wan raise two billion naira for the victims of that Abule Ado fire
E good now. Dem go need am
You know how he wan take raise am?
En wan make Nigerian citizens donate the money
Enh! Donate what? Government no get the money? Abeg make he pack well abeg, he think say na obodo oyinbo be this. Make people wey dey manage their selves come donate two billion for am, two billion wey fit loss enter the place wey e no suppose enter
Mazi, calm down now. No be you dem talk say go bring the whole two billion naira o
I no be Nigerian citizen?
Yes but other citizens dey wey go fit donate the money and dem no go even blink
Make those ones go donate the money. Nna enh, this heat don turn to something else; I no fit sleep last night at all at all
My brother same here and weather forecast people talk say between Wednesday this week and Friday; the heat go even increase the more
Tah. No talk that one oo
Na me talk am? Abi na weather forecast.
I no dey believe all these their weather forecast sef
Toh. No believe am now, until the heat jam you for eye na em you go know