Browsing: pidgin news

Make dem better hear because I go be the first person to report them. You hear say one professor for one agric university talk say en don find the cure to corona virus and lassa fever

Make you dey der dey ask quaytion. You no know say these beggars dey see money well well pass person wey dey go office? Why you think say dem dey protest for Sanwo Olu for lagos

E no be by force o. if the thing dey worry you too much and you don dey see say if you no commot, you go kill person; then e better make you commot. How you go kill you wife or your husband? Person wey you don vow to love until the day you go die

My brother, the thing wey dey pain me for all these politicians and journalist wey sabi talk well well; be say dem sabi talk according to their own selfish gain. If Femi Adesina no dey gain anything for this Buhari government, en for no talk the nonsense wey he talk now

Na wan woman for my place wey don dey Dubai for years, she come back this Christmas come talk say she don get job for my Ada for Dubai. As I do my investigation, I come discover say na human trafficking business the woman dey do for that Dubai

Hmmm, as we dey talk now one hundred people get lassa fever for Ondo alone and the lassa fever don even kill fifteen people. The situation dey worry Governor Akeredolu sef en come dey talk say people should be very careful