Nna enh, I hear the news this morning o, so sad. And you know the funny thing me and my wife been dey hear em music last night o. majek fashek, what a great musician
Browsing: Egbon and Mazi
Pidgin News, Egbon jimoh and Mazi okoroafor weekly episodes fun breakdown of News and happens around Nigeria.
With the world health crisis going on, reading the news can get inundating or even sad; that is why at everyevery.ng we have come up with a way for you to read the news without the intensity that comes with it. We’ve called it Pidgin News.
Our Pidgin news is not the typical reporting of the news in pidgin English; it’s two middle aged Nigerian men discussing the news with the little knowledge they have of the world. It promises humour and also knowledge of everything you need to know about what is going on in the country.
Ha ha, which kind talk be that abeg, how you go talk say technology na god just because of small video call?
Na wa for you o. small talk wey I talk with low voice e don enter be careful, make I wear mask and you tell you say I suppose wear mask while I dey talk to person for phone? Even if I get cough I no suppose wear mask to talk to you for phone
Nna enh, the wahala of network for this country. No be so I get serious video call yesterday and network no good.
Haba? Who insult you now? Na because I ask simple question na em you come dey talk say I dey insult you? Abeg leave that wan make we discuss sallah break discussion.
Ahn ahn, that is good. Na good law be this. So you mean say with this new law now the thing wey yahaya bello do wey en no gree pay in deputy salary for two years no go ever happen again?
f you ask me, who I go ask. Even me sef don tire. I think say whether na last month accountant general office too catch fire.
Mtshw, instead of you to talk say you done chop wan better food or you drink correct beer this morning; you come dey tell me about natural joy. Natural joy my foot.
No be the scamdemic wey you talk now now be the corona cake? Instead of dem to use the money to buy or make more test kits and test more people; dem don start to dey share the money.
Egbon, how far now? How you dey today? I dey o Mazi. How things? I just dey read wan thing…
Chineke! Wait fes, I no understand. Which kind demolish you dey talk of? The kind demolish wey dey scatter the entire hotel to the ground?
How e no go hire good lawyers. With all the money wey Orji Uzor Kalu steal; you think say na small lawyers en go carry follow go court?
Which transfer? I run commot oh. If corona go catch me no be for bank, make e come meet me for house abeg. You no even hear of one man wey even faint sef because en no fit breath well
I no talk say you no work now, na wetin I talk be that? I just dey tell you say I no dey follow other people resume office but I go dey work from my house.
Ehn? Two hundred and what? I no understand, shey dem talk say with the measures on ground dem go reduce the new cases of corona?
Make I help you understand. You see enh, NCDC announce today say the new cases wey commot reach one hundred and ninety five; you know wetin e mean? E mean say cases don dey fire up and if cases dey fire up like this, commoting of lockdown no be good news at all at all and for you to go open shop and risk your health that wan too no be good news.
E no surprise me now; when all these oyinbo countries never commot their lockdown, na Ghana wan form nonsense. Mtshw
I don talk my own. You how I no like fake news because fake news dey cause serious problem for this world; some people don die because of fake news. No talk say I dey spread fake news, instead just talk say dey wan wey I hear no correct
No be say dem wan use BVN give people money but na your BVN dem go use know whether you get money or you no get money
Dem dey play too much; everything dey easily turn to play for their eyes. Ehen, you see for news say Abba Kyari no even contact NCDC wen en catch corona?
I dey tell you. And you know say trip wey carry Kyari go Germany that time, no be him suppose go; na Osibanjo suppose go that Germany trip