I no go come myself, na government I go send make dem come evacuate you dey way wey dem dey evacuate people from different country; you go tell me the thing wey dey that east wey you no fit siddon for Abuja
Browsing: news
E no be any spiritual problem jare. You fit talk say the flood wey dey for Benin be spiritual problem but not the flood in lagos state
I happy say you call oyinbo land, you no call naija… na oyinbo land we dey? And even for that oyinbo wey corona dey kill dem anyhow, dem no get interstate travel ban
I even surprise say dem do the burial on time, I think say all these delay wey Abiola Ajimobi family dey announce go turn to family quarrel; you know as death of a family leader fit scatter the family way.
Oh. Na dey saga wey you dey talk be that? E get anybody for this country wey no know who Hushpuppi be or wey no know say dem don arrest en head for Dubai?
Na wa for you o. no be you no wan commot your house because of coronavirus? And even as government don talk say we fit commot house; you still no wan commot your house and vaccine trial mean say very soon coronavirus medicine go fall out and you go fit commot your house
You know wetin dey pain me pass? The fact say we get people wey get brain and plenty talent for this country and yet our government and some useless citizen dey destroy the effort of good people… dey give us international disgrace
In fact, as dem talk that review enh… me I come think say na to reduce the price; na em make me dey hail minister of power that time now because I think say dem wan do us good
Yes now, as government don kukuma open everything for the economy; I don dey go shop everyday o. but I no dey go today
As you talk say inspector general of police no die, I think say the next thing go be say en don catch corona virus because I see news before I sleep last night say 22 doctors and 60 other health workers don catch corona virus for rivers state.
Na em show corona the road to abia state now. I hope say e no go turn into something else for am o; make e just receive treatment and heal fast fast
Nna enh, the thing wey I hear na say dem don discharge up to one hundred and one people; no be say e now be coronavirus free o
I know now, no be me and you discuss am that day. But wait first na kirikiri prison dem put orji uzor kalu? Na wa o I no know o
Ha ha, which kind talk be that abeg, how you go talk say technology na god just because of small video call?
Na wa for you o. small talk wey I talk with low voice e don enter be careful, make I wear mask and you tell you say I suppose wear mask while I dey talk to person for phone? Even if I get cough I no suppose wear mask to talk to you for phone
Nna enh, the wahala of network for this country. No be so I get serious video call yesterday and network no good.
Haba? Who insult you now? Na because I ask simple question na em you come dey talk say I dey insult you? Abeg leave that wan make we discuss sallah break discussion.
f you ask me, who I go ask. Even me sef don tire. I think say whether na last month accountant general office too catch fire.
Mtshw, instead of you to talk say you done chop wan better food or you drink correct beer this morning; you come dey tell me about natural joy. Natural joy my foot.
No be the scamdemic wey you talk now now be the corona cake? Instead of dem to use the money to buy or make more test kits and test more people; dem don start to dey share the money.
Egbon, how far now? How you dey today? I dey o Mazi. How things? I just dey read wan thing…