Nna enh, na so these Chinese people be. If you leave them enh, the thing wey you no suppose give them. Dem go collect am for your korokor eye; I dey do business with some of them and I know how dem be.
Browsing: Egbon and Mazi
Pidgin News, Egbon jimoh and Mazi okoroafor weekly episodes fun breakdown of News and happens around Nigeria.
With the world health crisis going on, reading the news can get inundating or even sad; that is why at everyevery.ng we have come up with a way for you to read the news without the intensity that comes with it. We’ve called it Pidgin News.
Our Pidgin news is not the typical reporting of the news in pidgin English; it’s two middle aged Nigerian men discussing the news with the little knowledge they have of the world. It promises humour and also knowledge of everything you need to know about what is going on in the country.
Aaah, fear not. I just dey hail you; as you dey waka with this your stick and red cab like the prince of ukpaka hills and valleys na em sweet my body
Coronavirus never catch am but the problem be say federal government no even wan fight to bring all the Nigerians wey dey China. Dem dey talk say if need be dem go carry plane go bring dem but need never arise
Nna enh, leave that thing; if I tell my wife say I wan go the ultimate love win house for our family she no go vex at all… e be like say you no know my wife.
Ahhh, I never talk that one o. I just talk say if I go east, I no go enter any trouble because I dey hear igbo small small. That aside, Mazi you see news of man wey kill en cousin for road with stone?
Egbon, sometimes the kind talk wey you dey talk just dey make me wonder whether the ogogoro wey you dey drink get another thing inside. Wetin concine me with hyena?
E no be by force o. if the thing dey worry you too much and you don dey see say if you no commot, you go kill person; then e better make you commot. How you go kill you wife or your husband? Person wey you don vow to love until the day you go die
My brother, the thing wey dey pain me for all these politicians and journalist wey sabi talk well well; be say dem sabi talk according to their own selfish gain. If Femi Adesina no dey gain anything for this Buhari government, en for no talk the nonsense wey he talk now
Mazi, I no get any problem; I just wan understand wetin concern bird with tooth brush. CAN in my opinion has no business doing protest, protests for the Nigerian insecurity or anything at all is strictly for activists
Dem don dey arrest people over this corona virus o. the news just dey make me laugh. Five people just siddon decide say dem wan lie say dem get corona virus
Wetin happen? How you go ask me that kind question? Abi you never hear about this corona virus wey dey everywhere?
Na the person wey dem been wan give na em dem give; who Grammy award epp sef? How much the Grammy award go give person?
Na wan woman for my place wey don dey Dubai for years, she come back this Christmas come talk say she don get job for my Ada for Dubai. As I do my investigation, I come discover say na human trafficking business the woman dey do for that Dubai
Hmmm, as we dey talk now one hundred people get lassa fever for Ondo alone and the lassa fever don even kill fifteen people. The situation dey worry Governor Akeredolu sef en come dey talk say people should be very careful
Mazi, my own be say people wey dey fake kidnap ehn; make their punishment pass the people wey actually kidnap
Mazi, these our country people wey dey do fraud abroad no dey fear sef; everyday dem dey arrest our country people wey dey abroad for one type of fraud or the other
Honestly enh, as you dey ask me this question, I no know but dem don ordain am sha and even the Alaafin of Oyo dey advise am on how to comport enself as king
So with everything wey dey happen you no know? Okay, make I give you one small example. At this level port no suppose dey one Igbo state? Out of all the states for this country, no be Igbo states dey trade pass
But their fight different. For boxing na blow dem dey take knack their head and for wrestling na as e do you, anywhere wey you wan knack the personNa wa for
Na the same thing, Nigerian Police dey deny say dem no get hand in the demolishment of en house, say dem no even know say dem dey demolish any house wey Saraki get
Hmmm Egbon, you see as God save me enh. I be wan buy shop for that market o but something come tell me make I wait and the shop wey I suppose buy for that market that time na one of the shop wey catch fire for that market