Egbon, see me see wahala o
Ahn ahn, Mazi, wetin happen?
As you see me so, na so person for carry my daughter take do human trafficking
Ehn?! How come?
Na wan woman for my place wey don dey Dubai for years, she come back this Christmas come talk say she don get job for my Ada for Dubai. As I do my investigation, I come discover say na human trafficking business the woman dey do for that Dubai
Olorun ma je
Hmmn, my brother, Olorun will not agree o
Thank God say you do investigation; na so all parents and family members supposed do. If person promise your pikin work for abroad, you suppose investigate am check which kind job dem wan carry your pikin go do
I dey tell you. Imagine say I no come catch that woman; I for don enter one chance. She for just enter human trafficking
Na real one chance Mazi. Na so Nigerian immigration save about nine girls just recently from this human trafficking. Dem catch dem for Lagos airport
Thank God say dem catch dem come stop the journey o. Human trafficking na one of the worst things wey fit happen to person; some of them wey dem done traffick dey Gabon dey cry for Nigerian Government
Na wa o. Dem no go Nigerian embassy for Gabon to help dem?
Mazi, abeg no allow me make I laugh. Which time you hear say Nigerian Embassy for any country help person? Even the people wey go Russia go hook there, embassy no help dem. Dem send dem commot
You hear wetin Emir of Kano talk? en talk say the main cause of poverty for the north na polygamous marriage
Na true en talk. for north, you go see person wey never get money to feed himself wey get three wives and fifteen children and most of those children go dey beg for streets for money to buy food chop
I be wan blame their religion before but no be only northerners be muslim; we get Yoruba, edo and niger delta muslim and dem no dey marry and born they way wey northerners dey do am
Dey all need proper education. Maybe their chiefs and leaders go talk to dem and advice the younger men on how to marry. Tell dem not to marry amount of wives wey pass the money wey dem get
Dem go hear? You no know say the more wives you get for that their side the more prestige wey you get
This one wey you talk na another truth o. But they must do something about it. They must. I even hear say court don sentence one Kogi state former commissioner for agriculture to nineteen years in prison for embezzling nineteen million naira meant for cocoa farmers
Ahn ahn, that is good news. That is a small victory against corruption that Nigeria must celebrate.
Honestly, at least if people don dey go jail for things like this, e go start to dey reduce. And anybody wey wan thief inside government go think twice because en know say no be like old times wey you go dey sure say you go get away with am
Small small this country go become a better place
Yes o
Make I come dey go work
Ahn ahn, na by this time you dey come dey go work?
My brother, body no be fire wood; sometimes sleep better pass work
You never hear say sleep na for the weak?
Ehn, you wey be strong person; no sleep now
I no say na me talk am, I just dey ask if you don hear am
Okay, I don hear