The number one Mazi of Umuohia, the only prince of the Okeke family and great trader of the east.
Egbon, this one wey you dey hail me like this, fear don dey catch me o
Aaah, fear not. I just dey hail you; as you dey waka with this your stick and red cab like the prince of ukpaka hills and valleys na em sweet my body
You sure say na that one? Abi you don hammer wan kind money?
You know say if I hammer, na you go first know
I hear you. Abeg I no be prince, no dey hail me like that for public before people go think say I don hammer and EFCC go come siddon for my case
Ha Ha, Mazi so you dey fear EFCC?
Who no dey fear EFCC? E get anybody wey dem no fit arrest? Those people no dey fear face o
At all o. Dem even arrest Late Prince Abubakar Audu son sef
Really? Wetin en do?
E go pass fraud and corruption?
I believe say if that Prince Abubakar Audu still dey alive dem no go fit touch en son like that. That en son don dey thief tey tey
As Prince Abubakar no dey again, na em dem see am as chance to carry the son for fraud. On top that one dem even arrest one of their staff wey dey thief from the office
I hear that one, say en dey thief the things wey dem carry from people house as evidence. But you go blame am? The money wey dem dey pay dem for that EFCC is small now
Abeg Mazi, no talk that one. Nothing for this life go justify thief
Ahn Ahn, why you dey talk like this? Even bible talk say if person wey dey hungry thief food from you make you allow dey person go
Tor, na food this EFCC staff thief? No. so wetin be en excuse. If the people wey suppose to dey fight against corruption start to dey thief then na hot pepper soup we enter now
Hmmm, I no go talk again because your mind dey set for this matter. Ehenh, you hear say national football association talk say dem no give Daniel Amokachi position of Super Eagles head of technical crew
Ehn? If dem no give am? Who dem come give?
I no know if dem give anybody but dey talk say the news na fake news, say dem no give am that position
Hmmm, na wa o. all these news outlets wey no go confirm their news before dem produce am. Na so dem talk say Buhari wan marry that time and na fake news
No o, that one no be fake news na real news
So if Buhari wan marry, wetin go stop am?
Phone am ask am now, na me you go ask?
Abeg jare, that news na fake news. Police IG don talk say Nigerian criminals get better guns and weapon pass Nigerian police
I no understand. Na thing of pride or na thing of shame? Why en dey tell us? How that one take be our problem abi no be government problem be that? And na problem sef? Government no fit go buy weapon wey pass their own?
Mazi relax, all these questions wey you dey ask fit kill person. The truth be say dem no know wetin dem dey do for police because if dem know, IG no go talk this nonsense wey en talk
Exactly, ahn ahn en talk am as if na thing of pride; Wetin government dey do with all our oil money wey dem no fit buy correct weapon? In short this matter don dey vex me. I dey go house
Na wa o. na like that?
Na like that.