Mazi, abeg I need wan small explanation
Egbon, which explanation again?
Abeg helep me understand why CAN dey do protest for the Nigerian insecurity, how that wan suppose help the country? Abeg helep me understand
Me sef, I no understand this question wey you dey ask me. Na Nigerian insecurity be your problem or na the protest be your problem?
Mazi, I no get any problem; I just wan understand wetin concern bird with tooth brush. CAN in my opinion has no business doing protest, protests for the Nigerian insecurity or anything at all is strictly for activists
Who talk that wan Egbon? This thing wey you talk now now, dey the constitution?
No, e no dey constitution but my own be say… see CAN na religious organization and dem no get any business with politics
So the thing wey you wan tell me now be say the Nigerian insecurity wey we dey experience now, na only politicians dey experience am, religious people no dey experience am?
Mazi, you no understand the thing wey I dey talk
Abeg helep me understand am abeg. Because you no fit talk that thing wey you dey talk. Anybody fit protest and yes, CAN na religious organization and if dem don see say dem wan add protesting to the prayers wey dem dey pray against this Nigerian insecurity wey we dey see so. Who you be to talk say e no good?
As you explain am so, you don make me understand because I just dey think say the only work of a religious organization na to dey pray but I been no know say dem fit organize protest
Dem fit and if you notice, the protest wey dem do na peaceful protest; nobody die and nobody fight and that na good example wey dem set. Even Buhari commend dem say the way wey dem do the protest na em good pass
But honestly government need to do something about the insecurity for this country
Dem don start now, no be Nigerian insecurity make Sanwo Olu ban keke napep and okada for lagos
Omo, that thing na die. A lot of people don lose their job and people wey no get motor dey see am seriously
The wahala na die o. you see picture of horse wey some people dey use?
I see am o. I even see picture of another horse wey collapse die for ground because work don tire am
Work die am abi hunger kill am. You no know this country, dem go use horse go from agege to ikorodu and dem no go give dey horse better food
That one too dey. Kai I no just envy lagosians at all
E go better. Sanwo olu don talk say dem go soon release buses and boats wey go carry people take transport over water
Which time en go do that one?
I no know ooo but I hear say dem don buy all those things and e don set to start work
Okay, that wan go better o. you hear say the Saudi Arabian ambassador to Nigerian don die?
Ahn ahn, wetin kill am?
I no know oo. Dem talk say en sleep and en no wake again
Na wa o. I hope say this wan no go come cause another trouble for this country. Make Saudi arabia no come talk say na we kill am
I no think say e go reach that side, e fit be say en dey sick before and the sickness finally carry am go
I pray so o because we no need any wahala from that Saudi arabia abeg
You dey fear dem?
Ahh… you wey dey talk, you no dey fear dem?
Small…
Okay, at least you admit small