Mazi, this one wey you dey waka as if na fight you dey come fight; wetin happen?
Egbon, you no go leave me? Mtshw my brother no be fight o; na one of my the people wey I dey do business with hook for China
Enh, Mazi… if e dey China then coronavirus don kill am be that
Coronavirus never catch am but the problem be say federal government no even wan fight to bring all the Nigerians wey dey China. Dem dey talk say if need be dem go carry plane go bring dem but need never arise
Need never arise? Which time need go arise for them? The time when all the Nigerians wey dey China don catch the virus na em the need go arise?
I just tire. Other countries don go dey carry their own citizens from China but na only this country go siddon dey talk nonsense
I dey tell you. Wetin that your customer go come do now? En no fit carry enself come back?
En fit but en dey even fear to commot house mingle with other people
That one too dey. Make en just manage remain until things clear small small
Na em I dey tell am but e no easy oo
E get anything for this life wey dey easy? Your EFCC Chairman talk say na corruption dey cause coronavirus
Na wa o. This na why we no dey get respect for this country; how corruption go take cause coronavirus
I know say I no be doctor but I know say corruption no dey cause coronavirus. If na like that then coronavirus for don end this country be that
Na so. Because en dey fight corruption no mean say make en dey talk useless talk and come dey deny am on top
En deny am?
Aaah. E deny am; talk say en no talk that kind talk and as e dey deny am, people dey release video of the time when e talk am. See life
Na wa for these our so called leaders. You don talk useless talk, why you come dey lie say you no talk am? En for just take style talk say en talk am as a way of discouraging people from corruption in his fight against corruption
Egbon, you sure say you no be politician? This one wey lie commot from your mouth like say the thing dey hang there since morning
Mazi, leave that thing… e no get anybody for this life wey no sabi lie when the time arises; just that some people don practise well well pass others
Na true you talk. You know say supreme court don adjourn Ihedioha and Uzodinma case for imo state governorship
I no even know say Uzodinma carry the case go court again
Nna enh, that case go dey court until their term finish o; and you see as court adjourn am now. E be like na so dem go dey adjourn am until en term finish because I know say PDP candidate no go win this case for court
But why Uzodinma no wan rest, dem don commot am as governor; make en go find another thing to do with en life now. Or make en go prepare to win the next election. All these court wahala no dey tire dem?
You just dey talk because you never experience am. Imagine say you use all your money do election and you win am den wan court go come tell you say you no be true winner; na like that you go just pack your load dey go? You no go even fight the case small?
As you put am like this, I don understand
You better oo. Atleast if you fight dem go know say you no dey do smear smear. You know how this things dey
I know I know
Good