Egbon, wetin dey make you laugh so?
No be news wey I dey read; one church talk say dem go soon start to dey do their service for computer so that people no go dey go church physically, all because of this corona virus wahala
Na wa o, this one na ultimate love for stupidity. Wetin that wan come mean? How dem go do am?
If you ask me, who I go ask? Maybe only the pastor go dey church and the people go dey house dey watch as en dey preach for church through their computer.
That one na stress now, instead make en just go record the preaching give en members so that dem go watch am for television
Ator, all these their computer thing don dey too much these days; I know no too trust am
Me sef ooo. Computer na still man make am and e fit cause wahala
I dey tell you. Ehen, Mazi you don hear of wan new show wey dem dey call ultimate love show?
Kai, e be like say I hear of am… no be the one wey dey like big brother but na only people wey wan marry dey the show?
Gbam. Na the show be that.
Abeg, I no understand that show. Wetin dem dey do inside. Abi na by force marriage dem go dey do? Because winner go dey at the end now
Me sef I no know but I no say this ultimate love go give them house
Ehn! A whole house?
Yes oh. The people wey fall in love and win am go carry house go o
This one no be ultimate love na ultimate house
Mazi, from the way wey you dey look; e be like say you wan go enter this ultimate show o
Dem go accept person like me?
Ha ha. Abeg no make me laugh. Which ultimate love you dey find? No be wife you get for house so?
Nna enh, leave that thing; if I tell my wife say I wan go the ultimate love win house for our family she no go vex at all… e be like say you no know my wife.
Abeg, commot that thinking from your brain; the show na for all these small small children no be for old person like you
Bad belle, na for your front I go enter the show now… show you ultimate something, na just say I no dey serious about am; if to say I serious all these one wey you dey talk no go hold me down
No be only hold you down, na hold you up… I no dey hold anything; if you wan enter that ultimate show… carry go
Egbon, you remember that Maryam girl wey stab her husband one time like that? Wey the news blow for the entire country
I go fit forget am? I don hear of en sentencing now
Omo. Na the ultimate punishment na en dem give am o. dem sentence am to death by hanging.
I dey tell you but wetin we expect? Na the thing wey she suppose get na em she get
Yes oo but you know the thing wey vex me pass for this matter? Na the way wey she just dey scream inside court. I see the video as dem dey sentence am to death and she just dey scream like goat wey dem wan kill
I see am too ooo. The thing make me pity am small because the truth be say na kill dem wan kill am
Abeg jare. Which kind pity? Which kind yeye pity? The time wey she dey kill person she no know. I vex because I just dey think say; this same girl wey dey fear death like this, na she kill person in cold blood. Stab her husband almost five times
My brother, na so life be. Thief dey fear say people go thief from am. Na so e be.
You don talk am finish. Make I come dey go, I go see you tomorrow
No problem.