Mazi, the kind trouble wey just dey everywhere for this country don dey tire me
Oh Egbon, na now e dey tire you? E don tire me since 1960. Left and right na one nsobu or the other
Abeg, wetin be nsobu?
Nsobu means trouble for igbo language and you dey form say you know my language pass me
Ahhh, I never talk that one o. I just talk say if I go east, I no go enter any trouble because I dey hear igbo small small. That aside, Mazi you see news of man wey kill en cousin for road with stone?
I see am o. En talk say dem enter business together and the business no work
That no be reason to kill am now
No be say en set out to kill am, dem dey quarrel for road and the quarrel come turn to real fight and en carry big stone knack en cousin head; na there the real trouble start
Na wa o. Yanga dey sleep trouble come wake am
I dey tell you. From small fight en don kill person and no be just person na en brother sef.
That na why I no dey like fight; fight no good. Some people wey wan die, you no go leave them make dem go die for another way; you go come allow dem use you as instrument of death
Nna enh, you don talk am finish. As you see me so, e no get anything way go make me fight talkless of fighting for road; there are other ways to solve problem
Indeed Mazi, many other ways. Even if en steal your money; you fit involve police to come help you solve am. Now dey money wey en don loss for business no go ever come back again and on top of that… prison things
Na real prison things…even Lyon don enter another trouble oo
Aaaah, I hear that one… the way wey dem commot am from office dey do like film show
But no be film show o. these days e be like say person no fit just win election get peace of mind
I dey tell you. You fit win election stay for one year then Supreme Court go come tell you to vamoose say you no be true winner
Kai but na real wahala be that o.
Serious trouble, dey way dem commot David Lyon as governor of Bayelsa state na the same thing dem do for Imo state
Nothing wey we no go see for this country. The trouble of corona virus never end and dem don start this their political wahala. I just dey pray say Lyon go go quietly
Me too ooo. No be the one wey en go just come dey cause trouble. You know say en fit gather en supporters start to dey cause riot for Bayelsa state
Make e no just try that one abeg. Make innocent people no come dey die because e no wan give up en governor position.
Tor, make we dey watch dey go.
Every day I just dey pray say dem go talk say Corona virus don die but e be like say e just dey spread dey go
Hmmm, even me sef I just dey pray say as e dey spread; the thing no go spread reach this country because lassa fever trouble never finish and if you add corona virus … na another level of wahala be that o
My brother, serious trouble. Where we go even start from?
I no even wan think am. Make we just dey pray say e no go reach this country
Amen o. Amen.