Mazi, wetin you dey do here? I been think say hyena don chop you, lick your bone finish
Egbon, sometimes the kind talk wey you dey talk just dey make me wonder whether the ogogoro wey you dey drink get another thing inside. Wetin concine me with hyena?
First of all Mazi, I no dey drink ogogoro na origin bitters I dey drink; and secondly, no be you tell me say you dey go Imo for a few days?
Again Egbon I ask, wetin concine me with hyena?
Ahn ahn, you no hear say hyena loose guard for Imo zoo?
Ehenh, which time?
Around the time wey you travel. Na em make me dey ask now
Dey ask me stupid question. If you even ask me sef, I no know wetin hyena be
Na animal the thing dey like dog wey dey laugh; I see am for television
Okay, I never see am before. I no know say zoo dey Imo state, talk less of hyena or dog wey dey laugh
Me sef I no know, na as I see the news na em I realized say zoo dey imo. You don ever go zoo for your life before?
I carry my pikin one time like that wey dem dey small, we see lion and tiger but I no see this hyena wey dey make you ask me all the kind question wey you dey ask me today
No be only one question I ask you? See the picture of thief wey dem burn for calabar
My god! Which kind thing be this? I know say thiefing no good but this their jungle justice no be am at all; see as them burn am like meat
And na fowl en thief o
Tufiakwa! So because of fowl na em dem burn am like this? This is not good now and Nigerian police no fit enter stop them before e reach this stage?
Na everything Nigerian police go see? And the thing be say no be every time dem dey burn the correct person. Sometimes na innocent person dem dey burn and na wen dem burn am finish dem go come realize say no be thief en be
How person go die like this just because en thief fowl; how much be fowl for market? Abi the fowl na golden fowl?
If you ask me who I go ask? You don hear say federal government release one thousand four hundred boko haram suspects?
What?! One thousand four hundred? Na lie abeg
Look am for yourself. Dem release dem because dem talk say dem don rehabilitate them
Abeg, wetin dem mean by dem don rehabilitate dem?
E mean say dem don teach dem not to dey do bad bad thing again; so now dem go dey do only good thing
Na wa o. and wetin dem use take rehabilitate dem wey go make sure say dem no go do bad bad thing again?
I no know ooo. The way the news the vex you na the same way e dey vex me and na still the same way e dey vex Nigerian soldiers.
Nigerian soldiers dey vex?
Na wa for you o. how dem no go vex? If na you dey Bornu dey fight boko haram and government come release them, you no go vex?
I go vex o. but this decision wey government take so, na risky decision because the chance that dem go go back to their bombing character dey very high
My brother na so everybody dey talk but government still no wan hear that one
Na only God go help us for this country; you cannot put your hopes in government.
At all at all. Make I come dey go
Okay. Take am easy