Browsing: news

Na wan woman for my place wey don dey Dubai for years, she come back this Christmas come talk say she don get job for my Ada for Dubai. As I do my investigation, I come discover say na human trafficking business the woman dey do for that Dubai

Hmmm, as we dey talk now one hundred people get lassa fever for Ondo alone and the lassa fever don even kill fifteen people. The situation dey worry Governor Akeredolu sef en come dey talk say people should be very careful

Honestly enh, as you dey ask me this question, I no know but dem don ordain am sha and even the Alaafin of Oyo dey advise am on how to comport enself as king

Hmmm Egbon, you see as God save me enh. I be wan buy shop for that market o but something come tell me make I wait and the shop wey I suppose buy for that market that time na one of the shop wey catch fire for that market

Registration for the 2020 Unified Tertiary Matriculations Examination (UTME) will start on January 13 and end on February 17, the Registrar of Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB), Prof. Ishaq Oloyede, has said.

Na em I dey ask since. Say most of our Nigerian teacher no know anything; we dey harass government about our education system but the truth be say the teachers are the core of the education system

Davido has issued a stern warning to the authority of popular Abuja church, Commonwealth Of Zion Assembly (COZA) over an advertorial on the Instagram page of its senior pastor, Boidun Fatoyinbo.

Mazi, at least you get money to withdraw. People who no get money to withdraw nkor. Common thirty thousand naira some people never see; you know see as Ogun state worker wan start their own strike because their minimum wage never enter

You supposed know all these entertainer, na dem sabi lie pass anybody wey dey for this world. Entertainers and politicians, I no know who lie pass. You know this musician Duncan Mighty… wey sing that song wey you too like wan time