Egbon, you know wetin do me today? Kai I don suffer
Mazi, wetin happen?
I dey for motor dey make call I no come know say the car dey reach army check point and I no drop the call
Mazi Mazi Mazi, you no know say you no suppose dey make call for army check point? It is against the law
I know but nna enh I couldn’t miss that call; my goods were arriving and I had to tell them which warehouse to put it. Soldier nearly flog me today o
So wetin come happen for the check point?
I begged now… na beg I take commot for that place. I knee down for that check point dey beg
Ha ha, na frog jump you for do this morning. Everytime I pass that check point people dey there dey do frog jump
Honestly, na God save person. From now on before I answer phone call I go first check if any check point dey the area but I get one question ehn. Wetin concern my innocent phone call with army wey dey do en work for check point; my call no mean say dem no fit do their work
Mazi, it is for security reasons. As you dey your phone call dem no know who you dey call or whether you wan use your phone on bomb for them
Dem dey use phone on bomb?
Yes now, phone dey do all types of things o… na why dem dey call am smart phone because e smart like human being
Mmh hmmm. This life. You hear wetin Oyo state governor talk?
Wetin he talk?
He talk say dem inherit an almost bankrupt state, say money no dey Oyo state at all at all
No money for am to chop, you know wetin I don discover? I don discover say na only when one politician no see money to chop na em he go come dey do anti-corruption fight
Na true you talk my brother. As money no dey Oyo state again, he come dey go up and down dey sing anti-corruption for person ear. If to say money dey na den en true colour go show
Yes, you no fit sing anti-corruption if you never resist true temptation to steal money. If he wan steal money now; which money en go steal? No temptation
Exactly!
Which one come be ISWAP?
No be The Islamic State of West African Province? I read say dem kill two soldiers and one policeman
Nawa, we never finish with Boko haram another one done join. Which time this one start now?
I know? Like I don dey talk before; the day government ready to do away with all the terrorist groups dem go do am, as for now na dem still dey condone am
How you go talk that one, so are you saying that all the soldiers that have died because of Boko haram died for nothing?
No be wetin I dey talk be that but Ahn ahn, are they saying that a whole government cannot disarm a terrorist group?
I understand wetin you dey talk but you know say these terrorism get more to the story than the thing wey dem dey tell us
Now you are talking, now you are talking. Just like this Sowore issue wey get more than what their telling us
You see say dem ask Sowore to sign death warrant deal
Gini bu death warrant deal?
Aaah, it is exactly what you think it is. They want him to sign his life to them
Ta, that he should use his own hand and eyes to sign away his life to them when he did not commit any crime?
That is what it is looking like
No no, I hope he did not sign it
He didn’t and that is why he is still in detention. I wonder how this whole thing will end
We are watching the film.
Na real film o