Egbon, how far now?
Mazi, I dey oo. This wan wey you no commot on time, wetin happen?
You know see my hand since? Why you know wan shake me?
Mazi, you no hear say dem talk say make we no dey shake hand unnecessarily becasue of this corona virus?
Na wa for you o, so because of corona virus you no go greet person
Oga sorry, na life and death matter and I never still buy hand sanitizer; so I just dey careful
Na you no like your life; I dey tell you since say I dey sell and my own na normal price, I no be like other traders wey don increase the price of their own
I think say government don threaten traders say anyone of them wey increase the price of mask and hand sanitizer go go jail
Yes o, na so dem talk but the truth be say some of these traders wey like money too much no go hear
Make dem better hear because I go be the first person to report them. You hear say one professor for one agric university talk say en don find the cure to corona virus and lassa fever
I hear am enh but I no believe am
Me, I go believe am when I see am and if na true den god don do am for us be that.
Make we dey watch am. Because the one wey I know na say China don share their corona virus medicine with us so that we go treat the people wey get am for this country
I hear that one too but that their medicine dey work? If e dey work, how come the people we get am still dey increase for that country?
If you ask me, who I go ask? Everything right now na touch and go. We go try the medicine wey china give us and we go try the medicine wey this professor dey claim say e dey cure am
How you go talk say make we dey do touch and go for human being life?
You get any better idea? Everything whether you like am or not na touch and go even the so called expert wey dey talk as if na dem know everything, na still touch and go dem dey do
Mazi, prevention is better than cure
You don talk am finish. Make everybody hear ooo. E better make you follow everything wey government say e go prevent corona virus than to catch and den come dey pray for cure
Yes ooo my brother, if you dey the place wey plenty people dey make you use face mask and if you too dey shake people make you carry hand sanitizer dey rub every thirty minutes
Mmnh hmmm and if you see person wey dey too cough and sneeze commot en side quick quick… run commot for that side
As for me sef, I no go dey go to place where crowd go too dey and I don start to dey drink vitamin C to increase my immune system
Ahn ahn, who come recommend that wan for you now?
Dem need to tell person. I know say vitamin C dey build immune system so me and my family don dey drink am
Hmmm, no go self-medicate in the name of corona virus dem come add another wahala to yourself. Na person wey sick dey take medicine
Vitamin C no be medicine
If e no be medicine den wetin en be?
Na… something to build my immune system
Which makes it medicine
Mtsshw. Your stubbornness no go allow make person explain something to you
No be so oo. I just dey talk before you go go bring problem wey no dey come enter your body.
I don hear.