Egbon, why you dey smile as if the yam wey you chop this morning, no be your money you use buy am or like all these teachers wey don fail their students.
Mazi, e be like say you me well well; see, CBN don reduce ATM withdrawal charges from sixty five naira to thirty five naira
You don’t mean it
I’m telling you, dem just slash am like that
This is wonderful news; me wey no like all these bank charges
You no hate am pass me. Because of bank charges e dey pepper me to put my money for bank. True
CBN try for this one. Sixty five naira no be small money… you fit join join am use am do better thing
You see say dem don arrest Shina Peller?
Who be Shina Peller?
One man for house of representative, na en get one big club for Lagos
Eheh, why dem come arrest am?
Say en been wan bail people wey come en club from police station and police come dey harass am; dem seize en phones come put am inside jail with the people we en come bail
You don’t mean it. Nawa o. wetin go come cause that kind bruhaha
I know for them, en people dey shout up and down say the commissioner of police must be involved
How he no go shout. Because police no gree look en position now; the commissioner of police must be involved. Mtshw
Another fire don start again o
Fire? Again? For where?
For one market for Benin
Nawa o… hope say e no kill people
I no know. Dem still dey investigate am… the full story never commot
You hear as dem talk say over nineteen thousand teachers failed the exam wey suppose qualify dem as teachers.
I hear o. so wetin dem come dey teach since?
Na em I dey ask since. Say most of our Nigerian teacher no know anything; we dey harass government about our education system but the truth be say the teachers are the core of the education system
You talk well and if the teachers no know wetin dem dey teach den wetin students go come go school dey learn
My own be say make the qualification exam become standard, so that anybody wey wan teach for this country go take that exam and we go know say en sabi teach well well
Na truth you talk. Because go education starts from the teacher; if to say teachers for this country dey standard, exam malpractice no go too dey like that
Yes, see as University of Abuja don expel one hundred students over the exam malpractice.
Nawa o. a whole one hundred?
How dem go take do? They have to purify their school
Yes. You are right. One rotten apple can spoil the rest
You don talk finish. I dey come
But you dey go now
I dey come