Hello Egbon, how far now?
Mazi, I dey o
Ahn ahn this wan wey your voice dey sound like this hope say you no get cough? E be like say you go wear mask before you talk to me o.
Na wa for you o. small talk wey I talk with low voice e don enter be careful, make I wear mask and you tell you say I suppose wear mask while I dey talk to person for phone? Even if I get cough I no suppose wear mask to talk to you for phone
Oh so you gree say you get cough?
I no talk say I get cough now. I say even if… e be like say you no dey hear English well sometimes.
Na you no dey hear English well. Me I don tell you o; if you know say na cough dey make your voice sound like this make you wear mask because if I wake up tomorrow morning with cough na you I go hold.
Ha ha see me see iron handle. Okay Mazi, I don wear mask.
You sure. I don wear am now, you dey hear am?
Okay good. Ehen I dey talk with my wife this morning how old people for Nigeria dey survive corona well well and dem talk say na old people go die
No be say old people go die but you no know say all this sickness na mostly old people get am and if dem come catch corona on top, e don be for them be that; if not old people everywhere dey survive corona. No be only Nigeria
Okay, I no know say na like that dem put am. Another fire don land again o
Hmmm my brother, I see the news o. na this market now… Olaleye market
You know wetin cause am?
I no know, nobody know yet and the fire start for night o when everybody done go sleep.
The things wey burn for that market reach billions of naira now
Aaaaah, kai what a waste of money. People wey get shop for that market go craze o
If I get shop for that market and my things burn like that; not even one remain, me sef go craze
Anybody die for the fire?
I no think so, if not dem for don announce am by now.
For this period wey corona don dey stress people… wear mask … no wear mask… na em all these big big fire just dey spoil people shops and goods everywhere.
Nna enh, even me sef I come understand am. As you see me so enh, everyday I dey on guard about that my shop wey dey market before one day person go come tell me say fire don burn am plus everything wey dey inside.
God forbid Mazi. God no go allow that kind thing. En know say na from der you dey take feed your household so e no go happen.
Amen o. amen. You don hear about INEC latest plans? INEC talk say from 2021 dem go start to dey do voting inside computer; say people no go line up again like before.
That wan better now; who wan go line up vote for this corona period
But you know say election dey come up for ondo and edo states; that one people go still line up but dem go wear mask and do social distancing
If na me, I no go even go vote sef. Prevention is better than cure.
Egbon, you too dey fear sef. Nothing dey wrong to wear mask and go vote for your state. Democracy go die because of corona?
E no go die o but e go change.
Na so we see am
Na so we see am o