Egbon, good afternoon o
Hmmm, Mazi. You don hear the thing wey happen for NIPOST?
Enh? Wetin happen?
Na fire o. fire don catch NIPOST headquarters o.
Na wa o. e get any week wey fire no go burn somewhere? Abi na person dey set all this fire wey dey happen?
If you ask me, who I go ask. Even me sef don tire. I think say whether na last month accountant general office too catch fire.
Yes and na even during wan money controversy na em the fire start. Hope say the fire no kill anybody?
I no think so. If the fire kill person dem for talk am for news or maybe dem no know yet.
Abeg o. make person no die for that fire o, no be for corona period fire go come kill person wey well.
Honestly, Federal government dey really bring all the Nigerians wey dey other countries o; dem don bring another batch.
Eheh, from which country?
E be like say this wan na from Saudi Arabia dem bring dem from.
That wan good now, because this no be the time to dey for another country o
At all. As things dey so; nobody know wetin go happen next. Everyday na so so different things we dey hear. Today na chloroquine, tomorrow na medicine from Madagascar, next tomorrow na vaccine wey oyinbo wan come test for our body.
That wan dey enh but the thing we dey worry me be say; at least every country get the thing wey dem dey do to help the condition fast fast. Madagascar don do their medicine, no be so?
Na so
Senegal don dey make their own test kits and now I hear say Rwanda don get robots wey go dey screen at least one hundred and fifty people per minute for corona. Wetin Nigeria dey do?
My brother, we no dey do anything. We no dey do any extra ordinary thing; something wey common to test people still dey cause drama for Kogi state.
So you mean dey never start to dey test people for Kogi?
Which test? No be for federal medical centre lokoja doctors dey para say dem no get protective gear and test kits and still yet people wey get corona symptoms dey come hospitals.
Na wa o. that is very dangerous for them now. If I be dem I go resign o
Resign? Resign make your family no get food to chop now, that wan na another wahala.
Wait fest. I wan know something
Wetin?
This yahaya bello wey be governor of kogi state enh, dem no fit impeach am? Because all the things we yen don do for that state deserve impeachment
Abeg no make me laugh. You think say na oyinbo we dey abi? For this country, no be like that dem dey impeach; impeachment no be according to the work wey you no do na according to the power wey you no get.
Chai. So na so people go just die because of this man incompetence.
Na so we see am; except if bubu wan step in and light fire for en head then maybe en go do something.
Which kind fire bubu go light for en head wey go make him do work?
Ahn ahn, why you dey talk as if bubu no get power? Bubu fit call am threaten am say if en no step up dem go replace am. Abi you no know say na something wey bubu fit do be that?
Hmmm, na true you talk. make bubu enter the matter quick quick o. this wan na case of people lives o.
Make we dey watch and see.
Abi na.