Today na your president birthday o enh; Mazi, wetin you go do for am?
Egbon, wetin I go do for am? Wetin en don do for me? Wetin Buhari don do for anybody for this country, even en wife sef no dey benefit anything from am as far as am concerned. E put money for my bank account?
No talk that one o. En cabal don benefit well well from this en reign; why you think say dem dey push am to run for third term because en don swell all their bank accounts
No matter wetin dem do Buhari no go get that third term. No be for this life time
Mazi, my own be say you no one knows tomorrow
This one I know… enh I no know tomorrow o but I know say Buhari no go get that third term. Egbon, abeg wetin be hacking?
Hacking na wen dem use computer take use internet steal your money from your bank account
Chai. So you mean say these yahoo yahoo boys fit use computer enter my bank account?
Dem fit o. If dem fit do am to Fashola, e no get who dem no fit do am to
Nna menh I dey go close all my bank accounts today… today today
Mazi wait first before you make any swift decision, no just go dey carry cash around; you are endangering yourself
Wetin you dey talk. I should leave my money in the bank where hackers can enter, take hand commot my money
You know say if you carry all your money from bank take put for house and thief enter carry everything now; wetin you go come do?
Ahn ahn, Egbon which kind bad prayer be that?
I no dey pray bad prayer for you, I am just spelling out the facts for you
Biko no spell armed robbery for me abeg
Tor sorry, I just dey tell you say if you carry cash possibility still dey for theif to carry am and if you wan go withdraw everything wey dey your bank account; you know say dem go charge you
No be normal withdrawal charges?
Which kind!? If you withdraw cash of one million naira now bank go collect up 20 or 50K from the money
Ehn! My hard earned money, just because I wan carry cash
Na wetin government talk now; dem say e go dey promote a cashless society
Which kind yeye cashless society. Make bank hold my money hostage and I no go fit withdraw am
Mazi, at least you get money to withdraw. People who no get money to withdraw nkor. Common thirty thousand naira some people never see; you know see as Ogun state worker wan start their own strike because their minimum wage never enter
I read am. Ogun state government never increase their minimum wage and now dem don dey threaten strike; for me enh, no be say Ogun state government no wan pay dem the newly increased minimum wage but e be like dem no even get the money to pay
“Rich people no get bank account na bank balance dem get”
How you take know that one?
I don do my own research, dem no get the money
Abeggi, which yeye research. Na still their wickedness and corruption
Corruption go still dey inside but honestly e still be like say dem no get the money to even pay the workers
Anyway, we dey watch. When the workers go on strike, they will produce the money whether them like am or not
You hear wetin Aregbesola talk?
Wetin en talk?
Say make government increase taxes for the rich people
Haha, these people just dey make me laugh; we never finish the one wey dey possible, na the thing wey en know say no fit happen for this country e dey talk.
My brother, the people wey go pass that kind bill na dey rich wey go pay the high tax. The police is the thief
Indeed oo. Indeed. Abeg make I come dey go
No problem. Bye bye