Mazi, these Chinese people get mind o
Egbon, wetin dem do?
You never hear say dem arrest sixteen Chinese people because dem come dey find oil for our grounds illegally. Dem dey use that digging machine for our water front without permission
Na wa o. So the corona virus problem dem get no be their concine, dem still wan come steal our oil?
My brother. Me I been think say Chinese people get oil for their country sef
For where? Dem no get oil o. you think say e dey easy to get oil for your country?
Hmm, e no dey easy o but these Chinese people get everything. Wetin dem need oil for again?
Na wa for you o. you think say oil money na play play money? Oil money pass every other money. You think say Chinese people no wise. Once dem find oil money come add am to the one wey dem already get. Gbam. E don be, be that
Hmmm, tor make dem dey find their oil in the right way or in another country no be for Nigerian dem go think say dem fit do anything wey dem wan do.
Nna enh, na so these Chinese people be. If you leave them enh, the thing wey you no suppose give them. Dem go collect am for your korokor eye; I dey do business with some of them and I know how dem be.
Make dem just hold their sef well well. You know say Tinubu dey serious with en plan to run for president in 2023.
I hear o. dem dey talk say en and Bubu no get any agreement; say en dey on en own. Oyo tins
Wetin that one come mean?
E mean say Bubu no go help en election the way wey en help Bubu election
Aah, that one no dey possible now; Bubu must to shake body for Tinubu if Tinubu dey run true true
No be by force now, as Bubu dey talk say en no get any agreement with Tinubu; no be by force
Yimu, all that one na story. Dem no get agreement for public but for inside parlour, dem get agreement.
Na you go know since you follow them inside parlour.
I know say na so you go talk but you ma know say the thing wey I talk na true
How I go take know? I be winch? See this news o. say one fake doctor don dey treat people for inside Kaduna state hospital for the past eleven years. Can you imagine?
Na wa o. Wetin Ezekiel no go see for Israel? You mean for good eleven years this man dey pose as doctor and nobody know? Hope say en no do operation for anybody for that hospital
I no think so, maybe na cough and catarrh en go dey treat
You, as you dey here so. You dey go hospital because of cough and catarrh?
If I no dey go. E no mean say people wey go go hospital because of cough and catarrh no dey. But eleven years dey too much for that hospital to not catch am
Honestly, wetin dem dey check. Dem no dey verify medical certificate for that hospital? Them need to arrest the MD of that hospital for endangerment.
En put people life in danger for good eleven years
The MD and the staff wey dem catch should both face consequences
But you know your country. When people shout finish, nothing go happen. We go forget the case and life go continue
Na true you talk sef. The fake lawyer wey practise for ten years; when dem catch am, no be so so noise people make and after that… nothing
Na so e be. Even this Chinese people case sef, after dem arrest dem; dem fit even release dem later.
Hmmm. This country. Na wa
Na real wa.