FG Wan Investigate Nigerians
Mazi: E look like say this government no wan sabi the thing wey dem dey do again o, which kind thing be this wan like this
Egbon: Na now you sabi say dem no sabi wetin dem dey do, na today i don dey talk am say this government too dey do things wey no get head
Mazi: True true, no be today you don dey talk am, but you see this wan wey i dey read shock me, dem say federal government wan begin to dey investigate Nigerians
Egbon: Ontop wetin o, why dem wan dey torchlight Nigerians matter?
Mazi: According to one of the people we dey help Buhari ontop social media, Lauretta Onochie, government wan carry Big torchlight look the matter of Nigerians wey dey live large, to fit sabi how dem dey take see money
Egbon: Hmmmm, well, if na that one e look like say dem get small point sake of say plenty Nigerians just dey show money and no be say dem get better Job wey dey give dem that kind money
Nigerians
Mazi: I no understand the kind eyes wey you dey take see this matter o, government wey wan sabi how people dey take see money, why dem no torchlight the reason why suffer head dey ma ma people
Egbon: If na this wan wey you talk now now, i don talk am say make government teach people how dem go fit catch fish, no be to dey carry small small fish give dem

Mazi: Me still think say this move wey government wan make no too follow o, make the thing no go look like SARS matter
Egbon: If dem wan do am well, make dem no allow make SARS run the package
Buhari Blames Health Workers In Nigeria
Mazi: My own opinion na say make government no do the kind thing wey go make people do ENDSARS again
Egbon: Make we see how dem go take do am, Mazi, con see as your Presido dey carry blame knack health workers head for this counntry
Mazi: Oh, no be your presido again, abi you self don start the Yoruba Nation something
Egbon: No be say i start Yoruba Nation something o, the thing be say i no go call am my presido anytime him do or talk the thing wey no follow
Mazi: So, na wetin him talk now wey no follow o
Egbon: Him talk say na the behaviour of Nurse plus Doctor for this country dey make some people travel commot go collect treatment for Obodo Oyinbo
Mazi: Well, him talk no too bad like that sake of say if you see how some Nurses dey behave, you no go like am
Egbon: Forget it, that one no be talk, him just dey try shift the blame wey government suppose carry put for another people head
Mazi: Which blame be that?
Egbon: If government no fit do better hospital, pay Health workers well, buy equipment, people go still dey run commot for this country go collect treatment abroad
Leah Sharibu Gives Birth Again
Mazi: Your point no too miss road, but those Health workers too suppose check the way dem dey talk to the people wey want collect treatment
Egbon: My point no miss road at all, na confirm i talk
Mazi: No be lie, wait o, i hear say Leah Sharibu don born pikin again
Egbon: Ah, for inside the place where Boko Haram keep am too?
Mazi: Na so i hear the tory o, dem talk say na the second pikin wey she go born since dem carry am that time
Egbon: E dey always pain my chest say government no dey face wetin dem suppose face for this country, see the time wey this girl don dey for Boko Haram side
Teacher Brutally Flogs 12 Year Old Pupil
Mazi: Make we no lie, government suppose find how dem go take rescue that innocent girl
Egbon: Na another thing dem go face, wait o, see how Teacher flog this boy, see him Bumbum

Mazi: Kai, where this one take happen?
Egbon: Dem say na Nsude Seminary school for Enugu State o, the person wey post am say the Teacher talk say the boy jump fence
Mazi: Some people get wicked mind, the Teacher suppose find another way to take punish the boy, no be this kind punishment now, maka why
Egbon: E tire me o, make i con dey go jare, we go see later
Mazi: Ok now