Mazi, you get social media account?
Egbon, which one come be social media account? Which kind account be that? Na for bank dem dey open am?
Ha ha, abeg no allow me make I laugh. Na for all these social media websites… you never hear of facebook before?
Which kind insult be that? I don hear of face book before now. Face book na the social media account?
Yes, face book is a type of social media site then when you come sign up for am dem go give you account
Oh oh oh. Na that type of account na em you dey talk? If na that wan, den I no get social media account… that one na for small children, our young ones
Dey there dey talk say na for young ones… me I get social media account and as a business man that you are, you suppose get am if you no know
Wetin concern me and my business with social media account?
Mazi, no ask that kind question o. you no know say with social media you fit carry your business go international… through social media you go meet all kinds of people from different parts of the world wey you fit sell market to
You don’t mean it. In fact I don open this account, how dem dey do am
Relax, no crowd me… I go show you how dem dey do am later.
Abeg, make we do am quick quick… make I start to dey search for new customers
Eheh, speaking of searching… you hear say IBB dey search for wife?
I never hear that one
En dey serious o… and dey talk wey en talk na reasonable talk because he doesn’t want a someone who is too young. En talk say he want person wey dey close to en age so that dem go relate well well.
He get sense be that… because if na young wife he dey find. I for tell am say na die en wan die quick be that because the kind things wey young women dey do these days… e dey kill person
You know need to tell me… I don see with my koro koro eyes
Egbon, how you take see am, you don dey follow small girls?
No oh. I no follow anybody oh… I dey see wetin dey happen to the old men wey dey follow small girls and wetin dem dey take their eyes see
Okay. I for say. Ehen, I be wan tell you say from now on anytime wey you wan chop; you have to careful of the place wey you go chop
Wetin happen?
I read say some of these restaurants don dey cook with paracetamol because e dey make food don fast
Ehn!!! For this town?
Me I don talk my own, just be careful… if dem dey put paracetamol for person food den dem fit put another thing
But why? Why dem come dey put am… paracetamol no be medicine? Why dem come dey put am for person food?
For wetin I read, dem talk say en dey make food done fast fast
But that is not right… dey are drugging their customers in the name of convenience… that is not right at all at all
Me I don warn you, before you go go chop food wey dem put tetracycline inside come collapse for person. I no like hospital environment
Na you go chop tetracycline faint
Nawa for you, person no fit joke with you again?
Ehn ehn, I no dey like that kind joke
Tor no vex. I dey come make I go market small
Ok. Till tomorrow.