Browsing: egbon and mazi

So how that judgment take concine you? Yes, I agree with the thing wey dem dey do for kaduna; anybody wey wan go rape person pikin, make dem castrate am. Since e no wan get self-control… government go give am self control

Na wa o. your patience don loss this morning. The good part be say fuel price fit reduce to the barest minimum; if something happen now and fuel dey everywhere, the price of fuel fit reduce well well and you fit even buy fuel for twenty naira per litre

Egbon, you don talk am finish. You know say this corruption thing eh.. e no be only government, even citizens both rich and poor dey participate in corruption. You buy something for someone two hundred naira and you go and tell the person that you bought it five hundred naira… no be corruption?