Mazi, you don see the latest pictures of the flood in Lagos?
Hmmm, Egbon you no go even tell person good morning first before you start your news matter
Aaah, sorry o. oya good morning
Eheh, na now you dey talk. my brother I see some pictures of the flood in Lagos o; that their own flood, you sure say no be spiritual problem?
E no be any spiritual problem jare. You fit talk say the flood wey dey for Benin be spiritual problem but not the flood in lagos state
Why?
Because Lagos people no like good thing
Nne enh, I no understand this your talk o. e get anybody wey like make dirty water dey enter en house?
Mazi, leave that thing… I don talk am before and I go talk am again; lagos people no like good thing. Give them gutter and dem go turn am to dustin. Abi you wan tell me say na government cause the flood in lagos?
No be everything we go blame on top government head
Good. You never enter lagos before, you no see how dirty e be; abi you no know say gutter na for drainage no be for dust bin but if you enter lagos enh… dem don turn almost all the gutters into dust bin and den dem go come dey cry say make government do something about the flood in lagos
See enh, you dey look the matter from one side. The truth be say government and lagos people get hand for this matter. Yes, dem don turn most of the gutter their into dustbin but the truth be say their drainage system for that state no good at all
But the small wan, we dem get… wetin dem do with am?
The flood in lagos no be even today matter… e don tey and e don dey dey worsen by the year.
You no see the recent pictures of surulere?
Nna enh, I see am o. the whole place dey like wan giant dustbin.
And now wan school for dey blind dey don ask people to help dem because the flood in lagos don scatter their school and everything wey dey inside
Na wa o
Their whole school don turn into river.
But the sad thing be say, even if government wan do anything now enh, dem no go fit do am during this raining period, na during hammatan dem go fit do am.
Me I don talk my own… if you give lagos people gutter make water enter to pass dey go jejely.. dem go turn that gutter into dustbin and block am
No be everybody for lagos dey like that jor. You see the burial of that Ondo Commissioner wey die of corona?
I no see am o. wetin happen?
Same thing with the other politicians wey dem bury… too many people and no social distancing
E be like say na the new thing be this; people don accept am as the normal thing
As me and you dey talk now, who go correct the matter and make sure say e no go happen again?
Noburry!
Exactly, so na to just dey talk dey go… after all government don dey open everything up small small. Schools don dey open and even for Akwa Ibom state, dem don lift ban on weddings and burials
So, no more corona precaution?
My brother, if you ask me… who I go ask? Any precaution wey you wan precause go be dey wan wey you do for yourself because from the place wey I siddon so… everything do dey go back to normal and no be say corona cases do finish
Hmmm, na god go help person
Honestly.