Una no go allow me laugh for this country, how person go say assasins wan kill am and dem give am seven bullets for head but she no die
Mazi, Who be that?
Egbon, No be wan actress for Nollywood. Wetin be her name sef… see am Angela Okorie. Say doctors commot the bullets from her head
Doctors for this country? I go like know those doctors because I never hear that kind thing before.
Honestly, if one bullet catch your head; na go be that o and she dey talk say na seven … seven bullets! A whole seven bullets. The doctors wey commot am na superman doctors be dat
Real superman doctors but forget that thing, Na lie abeg, I no be doctor but I know say if seven bullets knack anybody head now… e no get how you go take survive am except en wear bulletproof for head
Me sef one of the doctors for national hospital done tell me say if bullet enter your head na your brain e go first catch. But why? Why person go just sit down dey lie hot lie wey fit catch fire?
“All the bullets wey cultists don throway no epp us”
You supposed know all these entertainers, na dem sabi lie pass anybody wey dey for this world. Entertainers and politicians, I no know who lie pass. You know this musician Duncan Mighty… wey sing that song wey you too like wan time
Yes Duncan mighty…wetin do am? E don die?
Which kind die… police arrest am now. You no hear say en too don join fraudsters?
Na lie!
Na true! Dem arrest am like two times sef. En be wan defraud government for the amount of eleven million naira
God forbid bad thing
God don forbid bad thing since but na we no wan hear. We still dey do bad thing up and down
So, even all these rich musicians dey do fraud?
Why you dey talk like this now… You be pikin?
Abeg no insult me because I ask you small question. I no be pikin but you no dey see their life style? With all the music wey dem dey sell especially this Duncan Mighty
No be by that one oh. You know whether en don finish all en money and he dey find quick money. You no go know
Na true you talk. As I no dey wear en shoe, I no go know; as we dey talk now sef I just realize say this fraud thing fit affect anybody … see as dem take do a whole Fashola 419
Ehenh.. . See that one. Dem no dey fear face again o. Anybody wey go gree give dem money dem go dupe am but dem don catch dem now
How dem no go catch them, a whole Minister of power… dem don catch them since. Their eye go see pepper
Correct pepper. I be wan go Lagos tomorrow but as I hear of this cult wahala wey dey kill people for Surulere I just dey here gidigbam
That cult thing don dey since beginning of this year o. Wetin government dey do to stop am because it is not fair on the civilians
Police say dem dey investigate the case
Na so so investigation we dey hear but no result. You know how many people don die because of these cultists for surulere?
How we go do now. Until dem investigate am finish na this Abuja I go dey
I don. Anyway… I dey go market
Sell market well o. Abeg no forget my cow
Which cow? You no serious. Mtshw. You give me money for cow?
But you know now
I no know anything… just face your front make I face my own
Na so e be now?
Na so e be