Aaah, Mazi, happy international women’s day
Egbon, I be woman? Which kind wahala be this? Even if you no be woman. Your wife no be woman? Your Ada no be woman?
Enh, go wish dem happy international women’s day for house; dem dey house
No problem. So, wetin you go do for them?
Do for them, unto wetin?
Ahn ahn, unto na international women’s day now. Abi you no dey recognize the importance of woman for your life?
You wey dey ask something. Wetin you do for your wife during this international women’s day wey you no wan gree me hear word
Aaah, Mazi no try me o. as I wake this morning, the first thing wey I do na to give my wife money make she go buy clothes and late today, I go carry her go that garden for zone three make we go chop fish and drink correct drink wash am down
Hmmm, na wa o. Egbon, I no know say na so you dey take international women’s day o. as you see me so, I get plenty work for shop; I no go get time for all these oyinbo oyinbo things wey you just talk now now
International women’s day no for oyinbo only; na the day wey you suppose celebrate all the women wey dey your life and don make you better
All the money wey I don dey give am since never do? Make I give am another one because na international women’s day. For Christmas, I give am, new year, valentine… make I give am for this one again and Easter don dey come small small, I go still give am money for that one
Women no dey do women. Na as you dey give dem, dem dey spend am
If e no dey do dem; make I rest abeg. I go use mouth wish am happy international women’s day and if she no like am, that one na her issue
Okay o. Asides international women’s day, today come be your vice president birthday o
Eheeh, I no know
En wife post birthday message for am sef on top internet. She call am her precious treasure
Why you come dey smile like that? Na you dem call precious treasure?
No be me but I dey like wen old couple like us dey do romance; the thing dey sweet me
Mtsshww. The oyinbo film wey you dey watch don start to dey affect you; how that one go come dey sweet you now. Wetin concine you with Message wey osibanjo wife sent to am for en birthday?
How e no go concine me? No be my vice president en be? E concine me abeg… no worry
You hear say court don stop the anti-corruption investigation against Sanusi?
I hear oh. Sanusi na powerful man now; e no go easy to come say you wan investigate am out of the blue. No be somebody like Sanusi
Asides the power wey en get sef; no be en time for EFCC wahala
Why you think so?
Because Buhari still be president now. You think say all the power wey en get na because en be Emir of Kano state? Na also because e get connection with Buhari and Bubu still be president and nobody go fit touch am now
If another president enter and that one no be en friend, na then wahala go start
Exactly.
Na wa for this life of politics sha; nothing is permanent
Not even a permanent secretary
My brother! Not even a permanent secretary oo
Hmmm. God dey. Make I come dey go
Okay o. go well.