Solution To Unemployment
Mazi: Nna ehn, e be like say i go reduce the way i dey reduce News o (cut in
Egbon: Why now, you no wan dey current again, abi you no know say na the News dey read make us know how things dey go for this country
Mazi: No be say i no wan dey current o, i just see say to see better news dey scarce these days, make person no go get high BP
Egbon: BP bawo, we no go get BP, Na to just make sure say we no too put the things wey dey happen for mind too much
Mazi: How person no go put am for mind, see this wan now o, dem say the number of people wey no get job don increase again
Egbon: My brother, i see the tory o, where dem talk say, people wey no get job don move from 23.18 percent go 33.3 percent
Mazi: Kai, that number plenty o, but na wetin be the solution to unemployment for this country like this
Egbon: I don talk am before and i go still dey talk am say our government no the solution to unemployment, the only thing na say dem no wan do am
Mazi: But why, if you ask me o, na unemployment dey cause most of the bad bad something wey dey play for this country o
Solution To Unemployment
Egbon: Instead make dem take all the Billions and Millions create hand work wey youths go fit do, dem go dey share 5,000 10,000 give people
Mazi: Hmmm, na better talk be that o, sake of say, most of the people wey dey collect the money just dey take am chop
Egbon: Before nko, instead make dem teach people how dem go fit dey catch fish, dem dey carry fish give dem
FG Advises Parents To Stay At Alert
Mazi: E look like say some people dey see something chop under the money wey dem dey share give people
Egbon: That kind thing no fit las at all, if to say government wan make these Pai pai plus kidnappings dissappear, dem suppose create job
Mazi: You talk am well, come see this tory o, federal government talk say dem no fit protect all the schools wey dey the country, say make parents no sleep ontop bicylcle
Egbon: And if i talk say this government don fall Naija people hand now, e go look like say i no like Buhari face, how government no go fit provide security
Mazi: But, if you check that talk, truth dey inside o
Egbon: Which kind truth be that, i no talk say make government dey protect all schools, but at least dem suppose fit take action wey go end these kidnapping something
Mazi: Hmmm, the bandits just dey collobi people dey go, na everyday with different tory
Egbon: Imagine, for country wey get government o, no be the other day i hear say the before before security Oga dem no buy Gun plus other Amunitions wey dem suppose buy
CAN Sues FG
Mazi: Na simple arithmetic now, Senate or House of reps suppose invite dem make dem con explain how the matter be now
Egbon: Explain keh, no be the Senate confirm say make government make dem ambassadors, Na Naija we dey my brother, na padi padi matter
Mazi: Na wa oh, i even hear say Christian Association of Nigeria don sue federal government
Egbon: Laugh, that wan serious o, wetin cause fight?
Mazi: No be fight, i hear say CAN carry federal government go court ontop that Law wey government wan take dey control church
Egbon: No be that one wey dem call CAMA 2020?
Mazi: Na him gangan
Third Wave Of COVID-19
Egbon: Dem go dey ok las las jare, shey you hear say COVID-19 don get thrid wave?
Mazi: Na which one be third wave again, the second wave don finish?
Egbon: I no even know for dem o, na PTF talk the thing, my own be say, make everybody just dey wash hand, use hand sanitizer plus face mask
Jealous Pregnant Woman Kills Husband
Mazi: Kai, Egbon con check this tory o, dem say this 22 year old girl wey get belle don take knife kill her husband for Delta
Egbon: Kill keh, e possible make e be say na bad economy cause am like that o
Mazi: No be bad economy, naa jealosuy cause am, dem say the girl wey bin don born pikin for another man before dey suspect say him husband get another lady outside
Egbon: Hmmm, see wetin hot temper dey cause o, now she go go learn lesson for inside prison
Mazi: Odikwa serious o, make i con dey go, we go see later
Egbon: Ok now