Adeboye Prays For Naira
Egbon: Naa small remain make this Naira no even get value again, imagine, naa 490 naira be $1 for where dem dey change am
Mazi: No be small something o, the thing dey affect my business, e get goods wey i suppose import, but the way the Naira dey go up, go down, no allow me know wetin i wan do
Egbon: Very serious, i even hear say Pastor Adeboye for Redeem don pray say Naira go dey strong again very soon
Mazi: Amen oooo, make Chineke God answer him prayer o, make Chineke consider people like us wey dey do business
Egbon: Pele o Businessman, shebi naa only you need the money, anyways, shey you don hear say dem don do am again, one day, new Sad tory for this Naija
Mazi: Wetin happen again, anybody don pai abi why you con dey shout like say House dey burn?
Egbon: If naa to say naa house dey burn e for better o, this wan wey happen don pass make house dey burn, Kidnappers no even look Bubu face, dem don kidnap plenty students for Katsina
Mazi: Chai, i bin dey think say naa Katsina be Bubu State now
Egbon: Yes now, naa why i talk am say the kidnappers no even look him face, to con make the matter worse patapata, naa the same day wey Bubu travel go him town for Daura the thing happen, imagine
Mazi: That one naa very bad something o, but you sure say this tory naa true like this, make e no be say naa fake News you wan dey carry up and down o
Egbon: Which kind question be that, i don carry any fake news give you before, naa inside Newspaper i read am and even Senator Shehu Sani talk say the thing naa true
Adeboye Prays For Naira
Mazi: Kai, if the tory naa true e mean say government suppose do something ontop insecurity matter for this country o
Egbon: You be hypocrite, so naa now government suppose do something, since wey different killing dey happen, no be you dey talk say make Naija people give government time, say dem dey (cut in..
Mazi: So, naa bad thing as i talk say make you give government time, no give dem time now, go use your magic stop the killings plus kidnapping wey dey happen
Egbon: Abeg, no insult me, if the state of Bubu himself no safe, naa which state con dey safe for this country, we still dey hope say dem go find the remaining Chibok girls wey dem kidnap for Borno, now dem don carry other students for Katsina
Mazi: I bin dey think say as the matter dey like this, naa prayer we suppose dey pray for this country o
Egbon: My brother, if you wan pray, pray for your family plus yourself, no waste your prayer ontop this country
Mazi: Ahhh, which kind talk be this, why you go talk say make i no pray for Naija, naa curse i suppose dey curse?
Egbon: God don bless us already, naa our government no do the thing wey dem suppose do make the country fit dey safe
Mazi: Tor, me, i sha know say naa prayer be the master key
Egbon: And naa you be the keyholder, abi?
Presidency Warns Against Calls For Break-Up
Mazi: If you know say naa insult you wan dey insult me, make we check another tory for inside the paper, i hear say federal government don warn say dem no go gree make anybody dey talk say make the country break
Egbon: Ehn ehn, naa who talk that one?
Mazi: Naa Garba Shehu talk am, him con say Bubu no go allow make anybody push am do wetin him no suppose do
Egbon: Nobody dey push am, naa him no wan hear true, if to say the country dey as e suppose dey, nobody go dey shout say make dem break am
Mazi: Hmmmm, but, naa small small now, no be one day dem take build rome o, we suppose get patience, make we con add prayer join, naa that time everything fit work o
Egbon: I hear your own, if you no wan hear my own, take care, i wan dey go my house
Mazi: No wahala, bye bye