Domestic Violence
Egbon: Kai, this News sweet my Belle o, Mazi, shey you don hear say that Channels Tv Reporter wey beat him wife don apologise and dem don settle the matter
Mazi: I don read the News, but i no understand why you dey happy ontop the matter o, Domestic violence no be something wey we suppose commot eye from
Egbon: My brother, naa better something if you ask me o, i even hear say naa Benue State governor, Samuel Ortom help dem settle the matter
Mazi: Imagine….., wetin concern Governor concern Domestic violence, i no see the thing wey him do as something wey people suppose clap ontop o
Egbon: But wait, shey wetin you dey try talk naa say make dem no settle the matter, make dem seperate dem as husband and wife, abi wetin be your point gangan
Mazi: I no talk say make dem no settle the matter, the thing naa say, dem suppose punish the man wey do that kind thing, how him go beat him wife wey just born
Domestic Violence
Egbon: Ore wa, i understand wetin you dey talk, but still i think wetin dey important pass naa say the wife don forgive him and dem don settle the matter
Mazi: Make i even ask you self, wetin concern Governor with domestic violence, shey him don settle all the matter wey need attention for him state
Egbon: The thing wey dey important pass naa say dem don settle the thing, the person wey settle am no matter, as for say dem suppose punish the husband, no be lie, but police no fit arrest the man if the wife no go report
FG Reduces Petrol Pump Price
Mazi: Tor, wetin even concern me self, shebi naa dem family, make we commot their level jare
Egbon: Domestic violence no be better something, also, Divorce no be good thing sake of say naa the Children go suffer the consequence
Mazi: Egbon, i don hear your own, i hear say government don reduce the amount wey dem dey sale petrol, naa true?
Egbon: Naso i hear am too o, i con hear say naa 5 naira dem dey plan to commot ontop the amount wey dem dey sale am before
Mazi: Ohhhh, and that one no be bad idea o, at least, e go reduce the amount wey Drivers dey collect from people
Egbon: Hisss, wetin be 5 naira ( cut in..
Mazi: 5 naira naa money, no be everything you suppose dey take bad eye look, at least dem do something
Egbon: Shebi naa you be the talk talk person for Federal government, aburo Lai Mohammed, wetin 5 naira fit buy for this country as things dey now?
Mazi: Naa me you dey ask, shey naa me reduce the money for petrol, which wan be my clothe wey you con dey hold
Buhari To Appear Before Lawmakers
Egbon: Abeg jare, the reduction no get any meaning
Mazi: Is ok o, at least i get right to my opinion, see this tory, dem say Bubu go show before lawmakers on Thursday
Egbon: I hope say him go show, because until i see am that Thursday, i no dey believe anything, but if i see him live, i go believe say no be audio something
Mazi: Naa everything you dey doubt, brother doubting Thomas
Egbon: Mtchwww, naa you sabi o, i wan dey go before you begin to dey insult me
Mazi: Nobody dey abuse you, naa you no like to dey hear true, anyways, take care