Egbon, good morning o
Mazi, good morning. This wan wey you dey happy so, money don enter?
E still dey come. So you never hear say we don dey make our own corona test kit for Nigeria
Enh! Which time this wan happen?
Na day before yesterday dem announce am o, say dem don succeed for lap and dem now know how to dey make corona test kit
Na good news be this now. So we no go dey buy or even beg for corona test kit from china again
Yes o but dem talk say dem never make am commercial
Wetin that wan come mean?
Even me sef no know. Maybe e mean say dem never make enough corona test kit to dey sell to people
But na so dem go do am. No be government property wey hospitals go use test everybody? Which wan come be dem go sell am to people
No be the meaning of commercial be that? Commercial mean say dem go sell am to people or maybe for this case e mean say dem go sell am to hospitals and other country
Ehen, this your second explanation make sense pass because now wey don dey make our own corona test kit, we fit sell am to other countries as well
Make we dey watch as e dey go, me I just happy say now wey we dey make our own corona test kit; dem go fit test everybody. No be the wan wey dem dey only test the people wey dem feel say need test or only the rich and big big people for this country.
Yes o but you know your country, dem fit change am come dey talk another thing; so make we just dey watch and see wetin dem go do. How far this Magu situation?
Nna enh, dem talk say en want bail o
Bail? I no know say dem even arrest am
I no think say dem arrest am but e be like say dem detain am
Hmmm, so which bail en dey find now? E don forget the corruption wey e dey when e suppose to dey catch people wey dey do the same corruption?
If na you, you go still ask for bail now; everybody go try their luck see if dem go release dem.
Wetin en wan commot prison come do sef? En work?
Which useless work? Work wey dem don suspend am from? Bubu don even replace Magu with another person
Wawu, I no know o. dem no waste time o. who dem replace am with?
Wan Mohammed Umar, I no know am; I never hear en name before.
Na wa o, e no get anything wey I no see for this country. You see the punishment wey dem set for rapists?
My brother, I see am o but I no understand am. How you go talk say if person rape person, dem go pay money or go to jail; so if the person na billionaire wey get all the money for this world… na so e go dey pay the money dey go and the money wey dem write no even be better money
As I see am enh, I just feel bad for the women for this country; government don talk say their worth no pass five million naira.
Exactly, because to put that kind judgement, e mean say government dey talk say na their worth be that. If I talk say this country never tire me, na big lie I dey lie
From one good news to fourteen bad news. I receive good news say we don dey make our corona test kit but that good news bring different different bad news.
I dey tell you. It is well
Indeed my brother.