Hello… good morning Mazi… I just dey think
Na wa o Egbon, I never even talk good morning finish and you don dey think. Okay wetin dey make you think this early morning.
Mazi, I just dey think of all dey international disgrace we don get as a country.
International disgrace? Na today we don dey disgrace ourselves for this country? Wetin dey make think am this morning?
You know wetin dey pain me pass? The fact say we get people wey get brain and plenty talent for this country and yet our government and some useless citizen dey destroy the effort of good people… dey give us international disgrace
Nna enh, when I tell you say we dey shit for market for this country, wetin you think say I mean? E mean say we no get shame and if you no get shame… na international disgrace be that now.
My brother, okay this morning as I see the news on this Invictus Obi boy; the thing pain me well well, e pain me like say en be my pikin.
That Invictus Obi story na unfortunate story
Very unfortunate because no be say en no be correct person o… no be say if en wan do good work and put this country for international map en no fit do am but instead en decide to do fraud and bring international disgrace to the country and en family
Honestly, sometimes I dey wonder wetin en mama and papa dey feel
The boy no be my son and see as en case dey pain me … so you go imagine how e go pain en mama and papa.
Wetin dem even talk for en case.
Dem talk say en don plead guilty now, dem go sentence am this October and from there… straight to jail
Unfortunate fortune.
Okay… see another international disgrace again o, you know say dem tell all African countries to bring three nominations for Director General of world trade organization
Yes, wey dem nominate Okonjo-Iweala
African Union don disqualify am now
Ahn ahn, wetin happen?
Wait make I knack you dey tori… dem talk say make Nigeria bring en own three nomination before deadline o. Nigeria bring nomination of three names including Fredrick Agah. E never do? No be wetin dem talk make dem do be that?
Na so dem talk
But e no do us because to follow simple rule na our problem. bubu come come say dem wan replace Fredrick Agah with Okonjo-Iweala after the African Union do already accept our own nomination and deadline for nomination don pass.
Our own thing for this country dey always different.
For this submission process I no hear of any wahala wey any other country cause; na only Nigeria… international disgrace
To even show say dem no think well before the submission… for that kind position the first person wey dem suppose even nominate in the first place na Okonjo-Iweala
My brother, who be Fedrick Agah? You know am?
If you wey dey read all these world trade organization tori no know am, how I go take know am?
Hmmmm, the thing tire me. Okonjo-Iweala suppose be the first name wey dem suppose nominate; in fact enh, na the only name wey dem suppose nominate if you ask me.
The woman get brain well well
But unfortunately for your government, they are bent on giving us international disgrace.
Honestly for them to disqualify our most viable candidate na real international disgrace and the annoying thing be say dem no disqualify am because she no good… dem disqualify am because our government no fit follow simple instructions.
You don talk am finish. Na the thing wey make me disturb you this morning o.
No problem. I understand. E go better
Mazi, e easy to believe say e go better
My brother, when there is life… there hope.
Okay o.