Mazi, wetin Bulus no go see for gate
Egbon, wetin happen?
You see this yahoo yahoo talk wey we dey talk every time, omo dem almost reach my turn last week o
Enh! You mean say dem almost do you four one nine?
Is like o. I met one man wey talk say en be CBN governor…
You no need to finish, I don complete the story for myself… no be the yahoo boy wey dem just arrest for impersonating the CBN governor?
Na em o.
You meet the fake CBN governor with your korokoro eyes?
I no meet am, na for phone we talk… he dey promise my nephew work but only if I give am money as token… you know how this yahoo boys dey do. En come really sound like the CBN governor
I know. You pay?
Which kind question be that now? You no know me again? First of all, I am not a supporter of people paying or bribing to get a job. It’s either you get the job on merit or you don’t
Me sef I no like am but how man go do now?
Man go do the right thing… see Mazi, change begins with you
Egbon… if your son no get job for ten years and get opportunity to pay for am to make something of en life… tell am say ‘change begins with you’
Abeg, no swear for my son… which kind negative talk be that now
No be swear I dey swear for your son, I just dey give example
Enh… no use my son destiny dey do that kind bad example
I don hear. You see another funny matter wey arise? Buhari media aide talk say AIT give Buhari African President of the Year award and AIT come talk say dem no give am any award
Which kind disgrace be this?
If you ask me, who I go ask? E be like say Buhari camp dey hunt for award to give am and as dem no see dem wan strong am AIT to give am the award
That one na scam abegi. Na so people dey collect award? So if dem tell Buhari now say en be the president of the year, with all the wahala wey dey this country en go believe am
Na that one I no just understand, with all the wahala wey dey on ground now… na award be en problem?
My own be say, if dem no wan give you award no be by force no come disgrace yourself dey lie say dem give you award wey dem no give you.
Ehen. I be wan tell you say EFCC dey auction motor wey dem seize o. you fit use this opportunity buy motor
Abeg leave that side. Motor wey dem don already share amongst themselves
Who tell you that wan?
Why you dey talk as if you no know they country wey you dey
This is my problem with Nigerians. You never even try first you don conclude say them don share the cars amongst themselves. Who tell you that one? You get proof? One of our biggest problems in this country na assumption
Okay o Mazi, before you eat me raw… I go go try am see if e go work
I know say you no go go but make we leave am.
Na wa o. e be like say Sowore go spend en Christmas in detention o
Hmm. Na so we see am. Wetin you wan do? You wan go protest?
You and who? As you dey see me so, na Christmas mode I enter now
You no need tell me because since last week, na so so Christmas clothe you don dey wear since.
Thank God say you know. I dey go chop
Make I follow you?
If you follow you go pay
Dey go dey go