Back To Lekki Toll Gate
Egbon: Laugh.. nothing wey Musa no go see for gate o, this country self naa one day, one Drama
Mazi: This wan wey you dey laugh like this, dis kind laugh get as e be o, wetin happen, Money don land?
Egbon: Money Money sha, no be money jare, no be this tory wey i see wey talk say Yahoo Boys do we no go gree for Osun state
Mazi: Ah, yahoo boys do we no go gree, i never hear that one be for o, how e take happen
Egbon: Hmmm, according to the tory o, dem talk say EFCC people too dey wahala dem for the state
Mazi: This wan full mouth o, but wait o, shey Yahoo Yahoo don turn normal Association for this country
Lekki Toll Gate
Egbon: Before nko, e show say dem do get Association be that now, no be why i talk say nothing wey Musa no go see for gate be that
Mazi: Kai, this matter don dey make me wonder o, me wey i still dey check the tory wey talk say some people wan organise another we no go gree for Lekki Toll Gate
Egbon: Shebi i don tell you before say dem wan do the we no go gree sake of say government bin dey plan to reopen the Lekki Toll Gate
Mazi: This wan naa another protest o, dem call am Defend Lagos, say dem take am counter those people wey wan do that before before protest
Egbon: Ehn ehn, so the matter don turn Occupy Lekki Toll Gate versus Defend Lagos
Mazi: Naso the matter be o, but the thing wey concern me pass na say make dem no turn am to another thing
NIN To Replace BVN
Egbon: Hmmm, Mazi, con check dis tory o, dem talk say federal government bin dey plan to take NIN replace BVN
Mazi: Which wan be this replacement something again now o, this people sha dey make me dey concern ontop my Business money
Egbon: Relax, Mazi the Businessman, your money dey safe, the thing na say dem wan make NIN take over as the thing wey Naija people go take do identity
Mazi: Ohhh, wetin go con happen to the BVN?
Egbon: I no fit answer that question o, but the Minister wey dey in charge of Communication, Isa Pantami talk say dem don follow CBN talk
Mazi: As this matter dey go like this, maybe i go waka go bank go collect my ego make i no con dey later hear tory wey no sweet for ear
Egbon: I say make you relax, naa just to take NIN replace BVN, e no concern your money
Gang Rape In Benue
Mazi: I hear your own, but the thing wey i go do dey my mind, con check this rape tory again o, kai, why people wicked like dis
Egbon: Hmm, this rape matter don dey pass becareful o, where this wan take happen now?
Mazi: Dem talk say na Benue the thing take happen say na like 4 boys gather rape one young girl like that, con record am ontop phone
Egbon: Oluwa o, why this kind thing con dey happen like this, na why i talk say government suppose do something be this
Mazi: No be lie, but parent self get duty, those boys now, na some people born dem, i even hear say dem parent dey try die the matter
Egbon: You see, na why government suppose take action be that, if dem don take 2 or 3 do example, others for don learn lesson, make i con dey move jare
Mazi: You talk am well, we go talk later