NIN Registration Deadline
Mazi: Hmmmm, the way wey many young people dey take find Money these days dey fear person o, dem just dey find am anyhow
Egbon: My brother, you no lie o, people dey over desperate to get money, dem wan get am by force
Mazi: No wonder why crime con dey plenty for the country like this, how person go dey chop live chicken sake of say him wan get money
Egbon: Live Chicken ke, you mean say dem no kill the chicken before dem chop am
Mazi: I dey tell you o, the video dey ontop social media now, dem say the young young guys naa Yahoo Boy, dem con dey chop the chicken raw
Egbon: Abi iru ki wa leleyi bawi, which kind thing be this, naso i read am for News say some people go thief Human skull for cemetry
Mazi: That one no be new something, e don dey before before, naa this live chicken own i never hear before
Egbon: If to say we get better government plus system wey dey ok, all these things no suppose dey common like this o
Mazi: No be everything we suppose dey blame ontop bad system, make we talk true, some youths too lazy
Egbon: No be lie, some of dem go wan drive car webi say the person wey don dey work for 35 years self never buy
Mazi: The matter tie wrapper o
Egbon: Kooda, e use make up join, shey you don hear the thing wey Yahaya Bello talk ontop COVID-19 vaccine palava?
Mazi: Wetin him talk o, because naa before him talk say COVID-19 no dey
Egbon: Him talk say that COVID-19 Vaccine naa plan to kill Naija people, say him no go take am
Mazi: Ahhh, which kind talk be that now, the vaccine wey plenty country bin dey wait for
Egbon: Me self wonder o, how him go dey talk that kind thing

NIN Registration Deadline
Mazi: As him talk that kind thing now, many people for the state no go follow the COVID-19 rules wey dem suppose follow to take reduce the thing
Egbon: I no just understand why a whole Governor go dey talk that kind thing
Mazi: Imagine and naso some people bin dey talk say dem wan make him become Naija Presido for 2023 o
Egbon: I no even fit imagine how him go take rule this country
Mazi: Wait o, shey you hear say naa today dem go start to dey block people sim cards sake of the NIN Registration Deadline.
Egbon: Ehn ehn, so naa today be the deadline, thank God say i don link my own sim cards o
Mazi: But plenty people never do the registration o, dem suppose still extend am make people fit register dem sim cards
Egbon: I no know how dem wan do the thing o
Bishop Kukah Gets New Appointment
Mazi: Government suppose still give people time, make dem fit do the linking something as e be say people no suppose gather sake of this virus
Egbon: Make we wait see how the matter go be now, shey you don hear say Bishop Kukah don get new appointment (read more here)
Mazi: Ehn ehn, i never hear that one o, naa who appoint am, naa federal government?
Egbon: No be government appointment o, naa Pope Francis give am the appointment
Mazi: I bin dey wonder say shey e possible make the federal government give am any appointment as him dey tackle Bubu government
Egbon: Dem say him go dey among the people wey go dey give the Pope advise ontop matter wey dey important
Mazi: That one naa better something o
Egbon: Abi now, aku imura ti Joe Biden
Mazi: Wetin that one mean o, abeg no sale me
Egbon: I only dey greet you say happy preparation for Biden inauguration as him dey prepare to take over from Trump
Mazi: Naa true o, so finally finally, Trump go pack him load commot for White House
Egbon: Naso o, anything wey get beginning must to get ending, naa the end be that
Mazi: No be lie, but America no go forget that man quick quick o
Egbon: For where, dem no fit forget all the thing wey him do, make i con dey go jare
Mazi: Oya now