COVID-19 Grant For Drivers
Mazi: (Song…., Chineke Idima o idima, idima eh, Chineke God o, las las i dey part of the people wey enter December, kai, my belle just dey sweet me, like say i win jackpot
Egbon: ( Song…, Ope lo ye keru oda o, ope loye keru o da, my brother true true, we suppose sing, dance and even thank Baba God say we see December
Mazi: This year 2020 naa Gen Gen.. ( cut in..
Egbon: Infact naa Elele, plenty something happen this year o, Kooda mouth no fit report everything wey eyes see for this year
Mazi: Naa to just thank Baba God o, him do me well no be small, see that lockdown, the virus, the protests plus plenty killings wey happen this year
Egbon: Oluwaseun, Naa Baba God we suppose praise o, imagine say him no protect us, shey naa this government we for rely upon say make dem protect us
Mazi: Hmmm, Egbon, just thank God, leave government alone, because i know say if we start to dey talk that government own, we no go talk am finish today
COVID-19 Grant For Drivers
Egbon: Tor, if you talk say make we no talk their matter, i don commot mouth o
Mazi: I no talk say make we no talk their matter, i no just want make you start to dey complain again
Egbon: I don tell you say make you no dey make am look like say naa me like to dey complain, no be this country we gather dey
Mazi: I don hear you, i even hear for news say government wan start to dey give drivers COVID-19 money, wey dem go fit hold body, dem call am COVID-19 Grant For Drivers
Egbon: That one no be bad idea, e make sense, but shey no be padi padi dem go take am do, abi dem go give everybody wey suppose get am
Mazi: According to the news o, dem no talk say naa political something o, dem say naa 4, 505 drivers dem go give the money for each state round Naija
Egbon: Nice one, i give federal government kudos, i carry Gbosa give dem like that, but naa how much be the money wey dem wan give each person self?
Mazi: Naa now you dey talk, if government do well, make we give dem Gbosa, i hear say naa 30,000 naira for each driver wey dey ride either Uber, Bolt, taxi, bus, Keke Napep, Okada plus other others
Egbon: My own be say, make dem no sha do Ojoro, make dem share am as e suppose be
Security Operatives Finally Arrest Maina
Mazi: I believe say government go share am as dem suppose share the money
Egbon: Naa that one go make sense o, Mazi, con check this Maina story o, dem say naa Niger Republic dem arrest am
Mazi: Hmmm, but wait o, how him take commot Nigeria go Niger Republic if no be say some people get hand inside the matter
Egbon: You see, shey you self dey see the thing wey i dey always talk, no be say him disappear commot, naa some people go get hand inside how him take commot for the country now
Mazi: O dika serious o, and dem con go put Ndume for prison sake of say naa him stand as him Sureity
Egbon: Dem don leave am say make him commot prison, and now wey dem don arrest am, the load go commot for Ndume head
Mazi: Ok sha, how Christmas wan be, abi you never start to dey prepare
Egbon: Naa make God keep our life, i wan buy foodstuff put for house before Christmas too near sake of say the thing go dey expensive when the celebration don close
Mazi: Naa true o, my brother make i con dey go
Egbon: No wahala, happy new month to you, help me greet your wife
Mazi: Same here my brother, naa the Joy wey dey my belle no make me greet you happy new month since, take care