Mazi, why are you crying? Did somebody die?
Egbon, my shop ooo. My shop has been burnt to ashes
Which one?
The one in Onitsha ooo
Aaaah! The Onitsha fire outbreak affected you?
The fire did not break out, it break into my shop and destroyed all my goods. I am finished
You are not finished. The government has promised to indemnify those affected by the fire
Wetin be indemnify?
The government will give you money for the damages you suffered in the fire
When did you hear this one?
E dey news now. Y you no cry for house? You come here dey cry for public
I no fit cry for house. If my wife know, na another cry be that. She tell me make I sell that shop since. I didn’t sell it instead I tell am say I don sell am make she no disturb me again, now see am. Onitsha fire ooooo
Na wa o. Wahala dey
Read Also: Egbon Jimoh (Episode 13)
Too much wahala
Sorry sha. I hope say government go do as dem talk if not
Sorry is my name ooooo Egbon.
No talk like that Mazi. When there is life, there is hope. Make we read small news commot your mind from this bad news
I no go fit read anything. Besides, na so so bad news dey everywhere. Dem expel 66 students for Nassarawa, Accident here and there, another fire for Onitsha don burst abi na break, dem don even impeach Kogi state deputy governor.
Shebi you talk say you no fit read? How you take know all these things?
Egbon, I see headline. Na the headline I see
You see as dem use abrachadabra take impeach Kogi state deputy governor? If you ask me, he should take them to court
Which court? And which money will he use to take them to court? Is it the allowance that they have not paid him in 2 years he will use to sue them? Abeg he should cut his losses and face his life
It’s a shame that a so called leader, a governor can treat people on his own team in such a cruel manner. Imagine what he will do to those opposing him
That governor is one of the worst in the country at the moment. At least, if you want to chop money why not pay people their salary and make some small improvements in the state before eating the money left
My brother. It’s only God that will help us in this country oooo. Only God
This second fire wey break for Onitsha kill anyone
For now, no but news fit change tomorrow
Take heart ehn, when God closes a door he opens a window
I no just know the thing wey I go tell my wife
She go understand. At least you don learn say next you go tell am true
I don learn.