Wizkid Celebrates Davido
Egbon: Some fans of all these musicians go just dey give themselves unnecessary headache, dey argue ontop wetin no suppose cause argument, their own too much self
Mazi: I bin dey think say na only me dey reason this thing o, especially those people wey dey support Wizkid plus Davido, dem just be like Day and Night wey no dey see eye to eye
Egbon: And las las, those people no too think am the way their fans they carry the matter like Dreadlock, no be so Davido post video where Wizkid dey dance to him song
Mazi: You see, na their fans dey drag wetin no reach to drag and the musicians’ dey chop life, dey make their money
Wizkid
Egbon: Naso o, some people go even dey argue ontop say which player rich pass between Messi and Ronaldo, i no know whether anyone of dem sabi those people wey dey argue up and down
Mazi: Hiss… No mind dem, you hear the thing wey Lai Mohammed talk again ontop Twitter matter
Egbon: Wetin him talk again, that man too talk
Mazi: Him say na Jack Dorsey, the owner of Twitter suppose pay for all the Kasala wey burst during that EndSARS time, say na him dey support the people wey do the protest
Egbon: This man sha, how him take support EndSARS protesters o
Mazi: Him talk say, Jack use him platform allow make people contribute bitcoin to take do EndSARS, con still create emoji for EndSARS, say the thing wey him cause pass wetin mouth fit talk finish
Boko Haram Confirms Shekau’s Death
Egbon: Abeg, make that man go find one place siddon jare, so people no get right to protest again, con check this tory, dem say Boko Haram don talk ontop their before before leader wey pai himself
Mazi: Ehn ehn, wetin dem talk?
Egbon: Dem talk say true true, Shekau don pai, but say that wan no con mean say dem don surrender give ISWAP o, say dem still dey kampe
Mazi: Na wa oh, but one thing wey i know na say God pass dem, him go finish dem plus all the people wey no wan make this country better
Egbon: Amin oh, no be so i hear say EFCC Oga, Abdulrasheed Bawa talk say some people dey try to kill him
Mazi: Imagine, the people wey no want make this country better plenty no be small, and na different different method dem go dey use, but Baba God pass all of dem
Egbon: Yes o, e even get one tory wey dey surprise me o, Mikel Obi talk say no Youth dey Qualify pass Yahaya Bello for 2023 Presido
Mazi: Which kain talk be that, dem don start to dey yarn Okpata like that, dem no go allow make the people wey wan vote see road
Pastor Defiles 19 Months Old Baby In Delta
Egbon: No be their fault now, if money don enter pocket, na anything dem fit yarn now, i no know wetin him do for Kogi state where him dey do governor, wey wan make him do Presido
Mazi: The thing wey matter pass na say make voters no go collect 1k con dey do anyhow when election time reach
Egbon: Some people conscience don die, infact, dem don bury am tey tey, dem go still collect the 1k, money wey no fit last for one week
Mazi: And later, dem go call dey cry say government no do well, egbon con check this tory o, kai why some people be like this self, dem say ekelebe arrest one Pastor for Delta State
Egbon: Wetin him do?
Mazi: Dem say him go do plo plo with 19 month old baby wey be him wife sister pikin o
Egbon: 19 month old baby keh, you sure say that man no get craze for inside him head like that, dem suppose carry am go where dem dey treat people wey don kolo
Mazi: Imagine, wetin him see for that small baby body
Egbon: Wo, until dem begin to dey commot the cucumber of anyman wey do this kain thing, some people no go stop, make i con dey go jare
Mazi: Hmm, we go see later now