Tinubu Looseguard
Mazi: I no know whether na me dey reason am like that o, or na true say NCDC no dey announce the number of COVID-19 cases again
Egbon: Mr current Affairs, na you no dey do follow up o, NCDC still dey announce the number every day, the only thing be say, e look like say the thing no plenty like before before
Mazi: Ehn ehn, i bin dey think say dem no dey record the number again since we don get COVID-19 vaccine for Naija
Egbon: Dem dey record am o, even the last wan wey i check, dem talk say na 121 cases Naija get
Mazi: Tor, e show say make we no loose guard be that, con see the thing wey Fani Kayode talk after him go collect COVID-19 vaccine for Abuja
Egbon: That man too talk abeg, na everytime him dey get something to talk, and everything na scope, no be him talk say make people no collect the COVID-19 vaccine that time
Mazi: I no know say you self never forget o, when him talk say, Bill Gates plus WHO bin dey plan to take style use the vaccine kill people for Africa
Egbon: I remember the thing well well, but na wetin him dey talk now
Mazi: Him don go collect the vaccine, con dey talk say the vaccine wey dey Naija no dey kill, say no be the kind wan wey him dey talk that time
Egbon: Na over talk dey worry that man, him go just dey talk talk with all him mouth, las las, na political strategy
Tinubu Looseguard
Mazi: No mind am, him dey try disguise sake of 2023 elections
Egbon: We go siddon dey wait dem, all these politicians bin dey think say Naija people never wise
Mazi: Na only myself i fit speak for, na each person go decide whether him don wise or still wan collect chicken change, but na election time we go sabi that one sha
Egbon: No be lie, but, shey you don see as Tinubu Looseguard for public
Mazi: Tinubu looseguard kwa, where, how and when him take looseguard?
Egbon: Na ontop the thing wey him talk when him dey do him 69th birthday o, where him talk say make Naija Military recruit 500 million youths, make the country fit win Boko Haram
Mazi: Hmmm, na wetin him con talk again now, i hope say him never talk say the number small because i no understand how him go talk say make dem recruit 500 million youths for military
Egbon: Him no kuku talk say the number small, him talk say na 50,000 him wan talk say no be 500 million
Mazi: You see, all these grandpa wey wan rule Naija by force self (cut in…
Egbon: Even when we still dey pray say make God save us from the condition wey dey ground like this, i no fit imagine say all these old people go still wan dey position o
Boko Haram Sponsors
Mazi: Baba God go kuku help man pikin for this country, i even read one tory where Garba Shehu dey talk say security people don dey torchlight the matter of the people wey dey sponsor Boko Haram plus bandits
Egbon: The Presidency never dey serious, na so so talk talk dem go dey talk up and down, so na who dey sponsor Boko Haram now
Mazi: According to Shehu, him say the sponsors dey work with all these Bureu the Change people dey wire money for Boko Haram members plus bandits
Egbon: Make dem gather dey take people life play game like that, instaed make dem do wetin dem suppose do, na so so talk
Mazi: Him say security people dey ontop the matter, con add say e go shock many people if dem hear those wey dey sponsor Boko Haram for Naija
Egbon: Na themselves dem go shock, dem no fit shock me sake of say nothing fit shock me ontop Naija matter again
Uniform For Married Men
Mazi: Make we leave that shock or no shock matter fast, con hear the thing wey one lady dey talk ontop men wey don marry o
Egbon: Her talk no fit pass cheating matter like that
Mazi: Like say you don read the gist before o, she talk say men wey don get wife suppose dey wear uniform
Egbon: Laugh, she no talk say make dem add socks plus cap join to make the uniform complete
Mazi: My brother, no be laugh matter o, she dey serious, talk say e look like say ring wey married men dey wear no dey say make dem no 2face again
Egbon: So, na uniform go stop am, that one no enter abeg, we mueve, we go talk later
Mazi: She don talk her own commot mouth, take care